• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News Business

Ban of bread wey no get label, reduced petrol sale – odd steps wey Zamfara goment take to reduce banditary

Sisi Eko by Sisi Eko
March 14, 2024
in Business
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di Govnor of Zamfara State, Dauda Lawal, don ban di sale of bread wey no get label for di state, as part of efforts to stop kidnapping and banditary.

Lawal also order say nobody go fit buy petrol pass 50 litres at a time for di state.

Dis na some of di tins wey dey inside an executive order wey di govnor sign on Wednesday.

According to di govnor toktok pesin, Sulaiman Bala Idris, di executive order become necessary “sake of di recent incident of attacks for some communities across some local goment areas, particularly Zurmi, Shinkafi, Kaura Namoda, and Talata mafara”.

“All bakery production companies and enterprises must label dia bread wit di full address and particulars of dia production factory wit immediate effect,” di order tok.

“All petroleum filling stations for di state no go sell more dan fifty (50) litres of petrol to vehicles at a time.

“Di sale of petroleum product for filling stations dey restricted from 6:00 a.m. to 6:00 p.m” – di order add.

Di executive order also tok say to transportation or sale pf bread “dey restricted within di capital of every local government”.

However, for di state capital wey be Gusau, “di restriction dey limited to some areas like Damba—Zaria Road; Gada Biyu—Sokoto Road; Command Guest House along Kaura Namoda Road; Gusau Garage—Dansadau Road”.

Di executive order also ban di use of cars wey get tinted glasses and cars wey no dem cover im licence plate number.

Wetin connect bread and banditary?

For interview wit di BBC, Idris tok say di reason for di executive order na to block supplies to di bandits.

E tok say goment wan also establish whether some bread manufacturers dey collaborate wit di bandits by supplying dem wit food.

Idris tok say goment no ban di making of bread, and di executive order no dey intended to stifle di bread industry.

“We know say bread na regular food for our kontri and our state. We also know say small business dey play important role for di economy, so we no go do anything wey go make business hard for dem,” e tok.

Similarly, a high ranking police officer wey no wan tok im name, tok say: “Sometimes wen we catch dis plenty bread for inside sacks, wey e dey clear say na bandits dem wan supply am, we go try to trace di bread makers, but as e be say di bread no get label, you no go fit know which company dey make am.”

“Na di same ting wit petrol. Majority of car fuel tanks no reach 50 litres, but you go see somebody wey go carry two or three 50 litres jerrycans come buy fuel. Na dis pipo dey supply bandits with fuel wey dem dey put for dia motorcycles. So di new law go make am difficult for di bandits to dey get supplies.”

About how goment wan take enforce di new executive order, Sulaiman tok say dat one no be wetin dem go reveal for press, rather “na wetin dey for goment and security operatives to do”.

Zamfara state for di North-West region of Nigeria na one of di states wia bandits dey disturb wella.

Di state also dey rich in mineral resources like gold and iron ore, wey experts tok say e follow for wetin dey cause insecurity sake of illegal mining activities.

In 2021, di Nigeria goment bin ban telephone ban telephone network in Zamfara  state sake of rising insecurity, but dat one no do much to stop di menace.

For November 2023, bandits bin attack villages for Zamfara and kidnap at lesser 100 popo. Also, in February dis year, gunmen attack a police headquarters for Zurmi village in Zamfara and kill seven pipo, including one police officer.

NHS hospitals with longest waiting times for England dey revealed

Tags: Zamfara
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Business

Why CBN wan make POS operators register, how 0.5% cybersecurity levy, deposit fee go take affect you

May 7, 2024
Apps

We go block any Loan App wey harrass customers – FCCPC

April 30, 2024
Business

Who be Binance executive Nadeem Anjarwalla wey dem see for Kenya

April 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version