• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home People

At least 28 out of 280 schoolchildren wey dem kidnap don escape 

Sisi Eko by Sisi Eko
March 9, 2024
in People
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

At least 28 of di almost 300 pikin dem wey gunmen kidnap don escape, na wetin Kaduna state govnor tell BBC News.

Nigerian Army dey find di pikin dem wey dem gbab from di northern town of Kuriga on Thursday 7 March.

Sojas dey work wit police and local search teams to search for inside di forests for Kaduna and oda states.

Na gangs of okada men wey get weapons gada di almost 300 primary and secondary school pikin dem between di ages of eight and 15, school authorities and parents tok.

One pikin wey dem bin reason say na 14 years bin collect bullet from di gunmen and don die since.

Kaduna govnor Uba Sani tell BBC say di lack of sojas for ground na im be di cause of increased kidnapping for di area.

Almost evri family for di town get pesin wey dey among di pipo dem kidnap.

Parents and relatives of di pipo wey dem kidnap don arrange to form vigilante groups and dey ask for help from oda communities close by to see if dem fit find wia dia pikin dey.

Dem dey search for Kastina and Zamfara states as well.

Nigeria Vice President Kashim Shettima dey go Kaduna and dey plan to meet di govnor.

President Bola Tinubu tok for social media say e dey confident say di hostages go dey rescued.

How di Kaduna school kidnap take happun?

‘How I escape from bandits wey kidnap 280 schoolchildren’ – Teacher

One teacher for Government Secondary School Kuriga for Kaduna state, north-west Nigeria say di gunmen wey storm di school on Thursday, 7 March kidnap 280 pupils and teachers afta head count.

Sani Abdullahi give dis informate wen di Kaduna state govnor, Uba Sani visit di community.

Gunmen bin ride motorcycles enta LEA Primary and Secondary School, Kuriga wen di students dey for assembly ground around 8:30am and kidnap di students wey dey between di ages of eight and 15 and teachers.

Dem shoot one girl wey currently dey for hospital now.

Govnor Sani say security agencies don dey find di missing children.

E say im don brief President Bola Tinubu and di National Security Adviser on the Kuriga situation.

“I don receive strong assurances from all of dem say measures dey in place to bring back di pupils and students.”

Oga Sani add say dem go establish Security Committee for Kuriga, wit members from key stakeholders for Kuriga community, security agencies plus di state goment.

Di mass abduction shock Nigerians and parents for Kuriga community dey traumatised.

Confusion dey for di community as residents say almost evri family get one child among di kidnapped victims.

Dem dey look up to di goment and security forces to help bring dia children home.

Teacher give account of wetin happun

On Thursday, one teacher for di affected school, Sani Abdullahi wey dey di school wen di kidnap happun and wey luckily escape from di gunmen tok how dem take enta di school premises and abduct pupils, students and teachers.

“I resume school today at exactly 7:47am. I enta di Acting Principal office and sign. All of a sudden, di acting principal say make I look my back and wen I turn, we discova say bandits don surround di school premises.

“We confuse, we no know wia to go. Den, di bandits ask us to enta bush, so we obey dem becos tiff plenty and di children wey follow us dey about 700. Wen we enta bush, I dey lucky to escape alongside many odas.

“I go back go di village and report wetin happun give di community. So, immediately, our vigilante and personnel of KADVS follow di bandits, but di vigilante no succeed, in fact, di bandits kill one of di vigilante.

Oga Abdullahi say local pipo bin try to rescue di children, but di gunmen attack dem and even kill one pesin.

Local media for Nigeria dey report say di Head teacher of di school and some pipo wey dey work for di school dey among di pipo wey dem kidnap.

For January, bandits kill one school principal for di area and kidnap im wife.

Dis na di latest inside oda incidents wey don happun for different parts of di kontri in di last 24 hours for di kontri wey security don remain one of di biggest challenges.

On Wednesday, tori of kidnapping and violent clashes don dey reported.

We go bring back all di abducted children – Gov. Uba Sani

Kaduna State govnor Uba Sani don assure members of di community say dem dey take all steps to ensure di safe return of di pupils and students.

E say I don brief “Mr. President and di National Security Adviser on di Kuriga situation. I receive strong assurances from dem say dem dey take all measures to bring back di pupils and students.

“Security Committee go dey established for Kuriga, wit membership drawn from key stakeholders for Kuriga Community, Security Agencies, plus di State Goment. I go make strong case give di Chief of Defence Staff and Chief of Army Staff for di establishment of Military Base for Kuriga to strengthen security for di area.” Uba assure di community members, especially parents of children wey dem kidnap.

Oda incidents wey don happun in di last 24 hours

For Borno state, dem don send one emergency response team to di remote area of Gamboru Ngala town, Northeastern Nigeria,

Dis na sake of di kidnap wey happun for one place wey displaced pipo dey stay.

Tori be say na suspected Boko haram jihadists go kidnap di pipo.

Di victims na mostly women wey dey live for camp for Gamboru Ngala town afta dem run comot from dia houses sake of attacks by jaguda pipo, locals tok.

Di kidnap happun wen di group go collect firewood to cook or sell, dem add.

Meanwhile di United Nations condemn di mass kidnapping of pipo – mainly women and girls – from di camp wia internally displaced pipo dey stay.

Di United Nations say make dem release di victims unconditionally.

For Benue state, local media dey report say almost 50 pipo fit don die including one family wey lose seven pipo.

Tori be say jaguda pipo wey dem suspect to be militia gang enta di Gbagir community for Ukum Local Goment Area on Tuesday morning.

Dem collabo wit di local Tiv bandits to remove anoda Tiv militia gang for di area.

According to reports, most of di pipo wey die na members of di opposite militia gangs.

Dis militia gang fight also affect farmers wey di mata no concern, but unfortunately dem waka enta inside di kasala. Almost 30 pipo wound and some pipo still dey miss.

Meanwhile on Wednesday, Nigeria Senate say dem go meet wit President Bola Tinubu to tok about insecurity for Benue State and Nigeria.

Di Senate say dem go meet President Bola Tinubu afta one “Motion On di Continuing Killings by Suspected Terrorists Parading as Herdsmen and Increasing Insecurity in Kwande, Ukum, Logo And Katsina-Ala Local Goment Areas for Benue North-East Senatorial District Of Benue State.” Come up for di house.

Na Senator Emmanuel Udende, wey dey represent Benue North-East, raise di issue under “Matters Of Urgent Public Importance Pursuant To Orders 41 And 51 of di Senate Standing Orders 2023 (As Amended).”

Udende, for im lead debate, say ova 50 residents of di Logo and Katsina-Ala area of di state don die and na men wey pretend like herders kill dem to cause kasala for di communities.

How forensic investigation show say Emefiele allegedly forge Buhari, Mustapha signatures take withdraw moni from CBN – EFCC

Tags: kidnapping
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Lifestyle

‘My 17-year-old son die within six hours afta dem begin blackmail am with im fotos’

June 5, 2024
Nigeria

Light off, schools close, airports grounded as NLC strike witness ogbonge compliance

June 4, 2024
Nigeria

Na offence to refuse to sing di national anthem as a Nigerian?

June 4, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version