Court of Appeal don confam All Progressives Congress (APC) candidate govnor Abdullahi Sule of Nasarawa as winner for di governorship election wey happun for di state.
David Ombugadu candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) bin dey challenge govnor Sule victory and elections tribunal bin grant am victory before dis development. After di 18 March elections di Independent National Electoral Commision (Inec) bin declare govnor Sule di winner with 347,209 votes while Ombugadu score 283,016 votes.
Delivering di judgement on Thursday, di three-member panel, led by Justice Uchechukwu Onyemenam, tok say di tribunal no do di right tin for law afta dem conclude say govnor Sule no win majority of di votes for di election. The Court also tok say di govnor no get fair hearing at di time.
Meanwhile, no be tori again say Court of Appeal for Nigeria don give judgements wey remove di govnors of Kano, Zamfara and Plateau states – all na for Northern Nigeria.
Wit di judgement of Nasarawa state expected shortly some say anoda upset dey on di way afta elections tribunal don already remove di govnor.
For Kano state Appeal court sack di incumbent govnor Abba Yusuf wey dem elect under di New Nigeria People’s Party (NNPP).
Di three-man panel wey Justice M.A Adumeh lead for di judgement on Friday 17 November say di NNPP govnor sake of say im name no dey for di party register, im no dey qualified to contest di election under a party wey im no be member. Court also tok say dem no sponsor am properly.
Dis one dey different from wetin di tribunal bin tok. APC and dia govnorship candidate Nasiru Gawuna bin challenge di victory of govnor Abba Kabir Yusuf of di New Nigeria Peoples Party (NNPP) for di 18 March 2023 elections.
For September di three-man tribunal panel presided over by Justice Oluyemi Akintan-Osadebay tok say 165,663 votes from oga Yusuf total votes dey invalid.
Dem also say di ballot papers no dey stamped or signed diafore dey invalid – so dem reduce di number of votes of di NNPP candidate by 165,663. But di appeal court no even tok about dis matter. Dia judgment na based on say Abba Yusuf no register well as a member of NNPP.
For Zamfara state di Court of Appeal for Abuja cancel di victory of govnor Dauda Lawal as dem call di results of di election wey hold for 18 March say e dey inconclusive.
For di judgement, di court ask Inec make dem run fresh elections for three local goment areas wey dem bin no conduct election before or dem no count results from di polling unit dia.
Dis judgement dey come afta former govnor Bello Mattawale wey bin dey contest file appeal on di mata.
Di latest judgement na from Plateau state wia di court of appeal in Abuja sack Mutfwang Manasseh as govnor of di state.
Delivering judgment on Sunday, di three-member panel of di court led by Elfrieda Williams-Dawodu tok say Manasseh no dey validly sponsored by im party di Peoples Democratic Party (PDP) for di election.
Na Nentawe Yilwatda, candidate of the All Progressives Congress (APC) bin dey challenge govnor Muftwang victory for court.
All di govnors don comot to yarn say dem no go give up and dem go carry di mata reach di highest court of di land di Supreme Court.
Lawal Lawal, one lawyer wey understand di matter dem for interview wit BBC News Pidgin say among di three govnors wey dey battle for dia seats na govnor Dauda Lawal get hope pass becos for im own case na im pipo go decide im fate.
“Why I tok say na Zamfara govnor get hope pass be say if Supreme Court uphold wetin court of appeal tok den na just for election to take place for three local goments for di state.”
“And we all know how govnors wey dey on seat dey act wen election dey happun for dia state.”
In di situation for Kano state di Lawyer dis one na serious argument go happun between both set of lawyers for Supreme Court and dat di case fit go either way.
“So based on di Court of Appeal ruling, di Kano govnor no be even member of di New Nigeria Peoples Party wey make am become govnor.
“So e dey up to im lawyers to prove otherwise. Dis case na serious argument go happun for Supreme Court.”
Barrister Lawal say among di three states na Plateau get di biggest wahala for Supreme Court as im party di PDP bin get crisis before March 2023 elections.
“So according to Court of Appeal, PDP no validly sponsor dia candidate well for di election because dem no hold congress or valid primaries for di govnor to emerge.
“So among di three cases I go say na Plateau get wahala pass because of di crisis wey PDP bin dey in before e emerge.”
So far, Appeal court don give judgement on governorship elections for six states. E get more states wey go get dia judgements.