• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News Politics

America highest court go rule if Trump fit run for president

Sisi Eko by Sisi Eko
January 6, 2024
in Politics, World
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di US Supreme Court don tok say dem go hear one historic case to determine weda Donald Trump fit run for president.

Di justices don agree to take up Oga Trump appeal against one decision by Colorado to remove am from di 2024 ballot for dat state.

Dem go hear di case for February and di ruling go apply nationwide.

Lawsuits for a number of states dey seek to disqualify Oga Trump, dem argue say e engage for di insurrection wey happun during US Capitol riot three years ago.

Di legal challenges dey hang on weda Civil War-era constitutional amendment render Oga Trump ineligible to stand as candidate.

Di Supreme Court decision to hear Oga Trump appeal come afta attorneys general from 27 states filed one brief wey ask di court to reject Colorado ruling.

Di 14th Amendment of di US Constitution don ban anyone wey “engage for insurrection or rebellion” from holding federal office, but di former president lawyers argue say dat law no apply to di president.

Im lawyers argue say: “Di Colorado Supreme Court decision go unconstitutionally exclude millions of voters for Colorado and dem fit likely use am as template to disenfranchise tens of millions of voters nationwide.”

Oga Trump don also appeal against one decision by electoral officials for Maine to remove am from di ballot.

Following di Supreme Court announcement on Friday, Colorado Secretary of State Jena Griswold tok say she don certify di state ballots for di upcoming presidential primary elections and Oga Trump name dey on dem.

Di primary ballots, wey go hold in each state, go help determine which presidential candidates go run for di November election.

Colorado primary dey set for di beginning of March – soon afta di Supreme Court decision on Oga Trump case.

“Di United States Supreme Court don accept di case, and Donald Trump go appear on di ballot as a result,” Ms Griswold tok for one statement.

Di split 4-3 decision by Colorado high court last month mark di first time for US history wey dem go use di 14th Amendment disqualify a presidential candidate from di ballot.

Dis na di first time di Supreme Court go consider how to interpret di clause.

Oga Trump na di current Republican front-runner for one likely rematch against President Joe Biden, wey be Democrat, for dis November election.

Courts for Minnesota and Michigan don dismiss attempts to disqualify Oga Trump. Other cases, including di one for Oregon, still dey pending.

Di US Supreme Court get one conservative majority – with three justices wey Oga Trump appoint wen e be president.

But dem rule against am well-well for im lawsuits wey challenge im defeat to Oga Biden for 2020.

Di court on Friday agree to fast-track di case, dem schedule oral arguments for 8 February.

Oga Trump legal team get until 18 January to file dia opening brief.

Di group wey dey argue for Mr Trump disqualification must submit dia argument by 31 January.

Di involvement of di top US court don draw comparisons to di 2000 presidential election between George Bush and Al Gore, wey end for lawsuit for di Supreme Court.

Di conservative-majority court decision to pause Florida vote bin handover victory give Oga Bush.

Cases for di Supreme Court normally dey take between four and 12 months – in contrast wit di few weeks wey di justices currently schedule.

Di timeline makes am likely say di court go issue judgement ahead of di Super Tuesday primary election for March, wen Colorado plus many oda states go hold dia election to decide on each party candidate for president.

On di day of di US Capitol riot, supporters of Oga Trump bin storm Congress as lawmakers dey certify Oga Biden election victory.

Dat day di then-president bin hold one rally outside di White House wia e bin repeat false claims of mass election fraud as e encourage protesters to “fight like hell”, but also to march “peacefully” go di Capitol.

Oga Trump critics argue e suppose dey disqualified no be only for im actions during di riot, but for im and im campaign efforts to overturn di election result in Republican-aligned states wia e lose.

While Oga Trump allege say efforts to sabotage di outcome of di 2020 presidential election na di focus of trials for federal court and one state court for Georgia, dem neva charge am criminally wit accuse say e incite insurrection for either case.

Bolanle Ninalowo deny di identity of viral sex tape video

Tags: Donald TrumpNews
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
People

Di Ghana 2024 elections registration wey dey target 623,000 new voters

May 9, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version