Nollywood actor, Nkem Owoh don las las open mouth tok since after the death of hin daughter, Kosisochukwu.
E con be say the pikin dey 24 years old, con die after she been dey suffer from liver cancer on June 28 2023. Dem bury am on thursday, August 18.
Since she die, the actor wey people sabi as Osoufia, comot from sociamedia so hin go fit mourn hin beloved pikin.

Hin enta hin instagram page on monday 28 drop message for hin people to show gratitude for the love and support wey hin family show when hin dey mourn hin pikin.
D 65 year old actor tok say hin dey feel deep loss as hin lose hin pikin say he no been dey mentally and emotionally ready for d loss. Hin con add say hin believe say dis kyn thing go do comot.

Na so hin take write am:
“I wan thank una for d support and love wey una show me and my family. When bad thing happen, e good to know say u no dey alone, na with better appreciation wey i use take collect una note and call. we don see many many chnages over d years but dis kyn change no b wetin i dey wait for and i dey feel big loss. i know say because of una help i go fit comot from dis phase. Thank you for helping me thru this bad time.
