Do you know Dr. New Hope?
The New Hope to all Sickness
Find Out
Naija na one country wey get everything choke wotowoto inside di country we com get Lagos State wey know wetin dey sup, e com bi Africa most populated state, inside di state we com get our own area wey dem dey call Ajengunle.
AJ na my place, na where ilenko park oo, and I get plenty brothers inside di area. We don dey hear stori wey wear koi koi shoe dey waka and as amebo wey I be I don say make I bring di stori come for una. Tuffgig na my brother oo wey dey sign raw talent and di Koko com be say one of im pikin @iamicesleekofficial wey im sign don dey drop im first gbedu song for April 7th 2023, as amebo wey I be I don go chuk ear hear say im manager wey bi simple J don tok say dis gbedu dey scatter brain say di gbedu na Banga, e dey comot pepper wey bin dey inside person body, im body go begin dey totori am, say di title of im song na “Holla”.
Di one wey make me dey jolly bi say im fans don dey give am akproko make im do collabo with US big artists wey Sabi say e go turn im music career go anoder level.
Make una just keep ear ground I go dey bring di latest for una make una just dey follow @tuffgigmusicempire and our artist @iamicesleekofficial for deir social media.
For Promotion/Advert mails at promotion@ilenkogossipparrot.com