• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

Sisi Eko by Sisi Eko
June 12, 2024
in News, World
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Hunter Biden conviction sake of e lie about im drug use on one handgun licence application matter go be one bad personal blow for im papa, Joe Biden.

Di US president double as di elder of a very close family wey don see dia share of personal tragedy and trauma.

Now dem don find im surviving son guilty of three federal crimes wey carry one possible long prison term.

But di verdict no dey likely to change how Americans go vote for November election.

Im papa name go dey on di ballot, no be im name.

No evidence wey connect president to im son offences. And plenti evidence no dey say di public dey follow dis trial closely.

Afta di verdict dey announced, di president bin release one statement wey hint about di double obligations wey dey need im attention.

“I be di president, but I also be papa,” e bin tok.

E bin add say e go kontinu to support im son and dey proud of di man im be today.

For di start of di trial, Joe Biden bin tok say im no go comment on di proceedings, but im son courtroom drama don follow am for weeks, as e bin conduct im official duties and campaign for re-election.

Hunter yet-to-dey determined punishment fit divert as di president dey prepare later dis month for one key presidential debate.

“Dis go, of course, be one personal distraction for di president, as e go be for any father,” Michael La Rosa, wey bin serve as press secretary for First Lady Jill Biden during di first two years of di Biden presidency tok.

“No be distraction from im duties as president, but I dey sure say e go take emotional toll on di family.”

While im dey France for D-Day commemorations last week, President Biden tok say e no go consider to use im authority to pardon im son.

And e bin add say e go accept di jury verdict – e dey different from how Donald Trump reject im own conviction say e dey rigged and corrupt.

Trump trial become supporter fight, wit Republican officials wey line up for back of di former president to condemn di proceedings.

Hunter conviction bin get different feel, to mark di high point of one dark period for Biden family wey don sabi dia own share of bad tins.

Hunter Biden coil into drug use around di time wey im brother, Beau, die from brain cancer.

Im battles wit addiction and how e affect im family relationships dey presented for one painful detail during di trial through quotes from Hunter memoir, im text messages and emails, fotos and testimony from those wey dey close to am.

All dat time, friends and members of Hunter Biden family – including First Lady Jill Biden and im wife, Melissa Cohen Biden – bin sit behind am, watch and sometimes hug am or hold im hand during breaks for di trial.

Im half-sister Ashley bin cry during di defence attorney closing arguments.

“Jill and I go always dey dia for Hunter and di rest of our family wit our love and support,” Oga Biden post-verdict statement bin conclude. “Notin go ever change dat.”

“Our family don go through plenti tins togeda,” Joe Biden earlier statement bin conclude, “and Jill and me go to kontinu to dey dia for Hunter and our family wit our love and support.”

Di prosecuting attorney during im closing argument bin tok say di evidence wey dem present dey ugly and personal.

E also tok say e dey touching and e dey necessary to show say when Hunter Biden bin fill out di federal background check application for handgun, e know say im lie wen e bin confam say e no dey use drugs.

For di end, a unanimous jury bin agree. Dis guilty verdict mean say di president son – di only pikin wey survive from im first wife, wey bin die togeda wit im baby daughter for car accident half century ago – fit face years for prison.

Hunter Biden now dey wait sentencing for im conviction, but even afta di judge decide im punishment im legal gbege no go dey over yet.

E dey also face one September trial ontop charges say e no pay $1.4m for federal income taxes.

Dat trial, wey dey come less dan two months bifor di election, fit no carry di raw emotion on wey dem show for di Delaware courtroom, but e fit prove to dey more bad for politics for di president.

Hunter foreign business dealings and im financial ties to di president don always be one source of kontinu check by Oga Biden Republican critics.

Drug addiction and di punishment of am dey touch many American lives. Allegations of financial corruption and tax fraud, however, fit generate less sympathy from di public wey go vote.

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

Tags: Joe BidenUSA
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
News

Tinubu appoint governing council members for Federal institutions – wetin be dia work?

May 18, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version