• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Nigeria

UNIPORT set panel to investigate lecturer wey appear inside sexual misconduct video

Sisi Eko by Sisi Eko
April 23, 2024
in Nigeria, Viral
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Authorities for University of Port Harcourt don make u-turn for dia response to one viral video wey bin show as one of di lecturers for di university dey sexually harass one female student.

Inside one statement wey di Vice Chancellor of di university release for im LinkedIn page, e say di management, “afta one emergency meeting” of di school set up one five man committee to torch light di mata.

Di panel wey im work na to investigate di incident dey expected to report back to management – dem get five days to complete dia mandate.

On Tuesday 22 April, one video wey bin show one man – allegedly lecturer for Uniport Department of Engineering – dey grab and touch touch one young girl wey dem never sabi her identity, bin blow for social media.

Di VC say di trending video of gross misconduct na against one lecturer for di Department of Mechanical Engineering and involve one female student wey dem never identify. But im no give di name of di lecturer.

For dia first response, di university bin reject tok say di incident happun for dia school or say di lecturer and student belong to dis school.

Tok tok pesin for di university, Sam Kpenu, tok for di first statement say di accusation no get head as nobody for di school don report any case of harassment.

E also claim say afta “thorough investigate” dem don “confam say di alleged incident no happun for di premises of UniPort or involve any of dia staff members.”

Kpenu, for later interview wit BBC say, as at di time wey im bin give di first statement, dem bin no get any report from anbody say anytin like that happun.

But add say afta management meeting on Tuesday, dem don get forml report and dem dey torch light di mata.

Sexual harassement for Nigeria institutions

Several tori dey ground of sexual harassment for Nigeria universities.

Di seriousness of lecturers harassing students in exchange for grades, marks, admission, grade alteration, make di former Nigeria President, Muhammadu Buhari say dem dey torchlight di matter through di Independent Corrupt Practices and Oda Offences Commission (ICPC).

For August 2023, di management of University of Calabar, bin suspend one lecturer, di Dean Faculty of Law, Professor Cyril Ndifon, for sexual abuse cases against female undergraduates for di school.

Ndifon mata bin reach ICPC wey charge am to court for sexual harassment and gratification against one 22 years old student.

For 2019, BBC bin do one investigate wey expose sexual harassment for Nigeri and Ghana universities.

Di investigate make Nigerians tok plenty on di palava of sex for grade and wetin dem bin tink na di way forward.

Still, despite di high rate of sexual misconduct among lecturers for Nigeria, authorities for higher institutions still dey ignore di mata, or no dey do enough to make di lecturers twice before dem commit.

Who be Binance executive Nadeem Anjarwalla wey dem see for Kenya

Tags: UNIPORT
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version