• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Lifestyle Food

How EFCC recova N30bn from poverty minister investigation

Sisi Eko by Sisi Eko
April 9, 2024
in Food, Nigeria, Politics
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Nigeria don recova 30bn naira ($24m; £19m) from one suspended minister as part of one ongoing corruption investigation, Financial watchdog tok.

Dem trace di moni go more dan 50 bank accounts.

Nigeria goment bin suspend di Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation Minister Betta Edu for January say she allegedly divert $640,000 public moni into personal bank account.

President Bola Tinubu come order investigation into her ministry.

At di time, Dr Edu wey be 37-year-old bin deny any wrongdoing. Her office tok say she bin approve di transfer into personal account, wey no dey in her name, but say na for di “implementation of grants to vulnerable groups”.

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) tok say during dia nearly six weeks of investigation, so far dem discova “many angles” to torchlight.

“As e dey now, we dey investigate ova 50 bank accounts wey we trace di moni enta. Dis no be child play. Na big deal,” dia chairman Ola Olukoyede tok for di latest edition of di agency monthly e-magazine, EFCC Alert.

E encourage Nigerians wey dey find justice to give di agency time to finish dia investigation thoroughly.

“We dey explore so many discoveries wey we don see for our investigation. If na to see say pipo dey for jail, make dem no worry, evritin get process to follow,” e tok.

Di EFCC chairmo give assurance say di funds dem recova don “already dey di purse of di federal goment”.

Di suspension of a minister no too common for Nigeria.

Why Tinubu suspend Betta Edu?

Betta Edu become di first minister under President Bola Tinubu to come under public condemnation for crime wey authorities and court neva confam say she commit.

Reports allege say she give instruction for di payment of one big moni – ova 585 million naira to one private account.

But di Accountant General of di federation for statement bin come out to say, dem no pay di said moni into di personal account as Betta bin instruct dem for her letter.

Dr Betta Edu na one of di women wey President Bola Tinubu inaugurate as part of im Executive Committee.

Wen dem swear am in about six months ago, her appointment as minister receive commendations as she be one of di youngest for di president cabinet.

Her portfolio also dey veri sensitive sake of say she go dey work wit youth, men and women, and dose wey need urgnt help wey natural or man-made disaster cause.

Eid al-Fitr for Jerusalem – ‘Joy no dey’

Tags: EFCC
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version