• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Faye officially declared winner of Senegal presidential election

Sisi Eko by Sisi Eko
March 28, 2024
in News, Politics
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Opposition candidate Bassirou Diomaye Faye don emerge as di winner of di 24 March presidential election wit 54.28% of total votes.

Faye score 2,434,751 votes while im main challenger former Prime Minister Amadou Ba of di ruling coalition secure 1,605,086 wey be 35.79% of total total votes.

Di voter turnout for di Sunday presidential election na 61%.

President Macky Sall bin attempt to delay di polls wey dem initially schedule for February.

Di outgoing president attempt bin spark violent protests and bin result in three deaths.

Bassirou Diomaye Faye extraordinary rise for Senegalese politics catch many pipo by surprise.

E bin dey jail for months alongside im ally and kingmaker Ousmane Sonko, but suddenly dem dey released from prison di week before di presidential election.

Now Mr Clean as dem nickname am gatz start work on di sweeping reforms e promise.

“Methodical” and “modest” na words pipo dey often use describe di tax collector, wey celebrate im 44th birthday on Monday.

Oga Faye fondly remember im rural upbringing for Ndiaganiao, wia e say im dey always go every Sunday to work di land.

Im love and respect for village life dey matched by im deep distrust of Senegal elites and establishment politics.

“E no ever be minister before and e no be statesman, so critics dey question im lack of experience,” analyst Alioune Tine tell BBC.

“But, from Faye point of view, di insiders wey don run di kontri since 1960 don make some terrible failures.”

Fighting poverty, injustice and corruption dey top of Mr Faye agenda.

Wen e still dey work for di Treasury, e and Oga Sonko bin create one union taskforce to tackle corruption.

Gas, oil, fishing and defence deals must all dey negotiated to better serve di Senegalese pipo, Oga Faye tok.

Senegal president-elect don tok say im go drop di much-criticised CFA franc currency, wey dey pegged to di euro and wey former colonial power France dey support.

Mr Faye wan replace am wit new Senegalese, or regional West African, currency, although dis no go dey easy.

‘Bassirou na me’

Dem bin announce Bassirou Diomaye Faye for February as di so-called “Plan B” candidate, wey replace di charismatic opposition firebrand Ousmane Sonko. “I go even say im get more integrity dan me,” Mr Sonko tok proudly.

Both men establish di now-disbanded Pastef party, both men na tax collectors, and both men find diasef jailed last year on charges dem tok say dey politically motivated.

Dem convict Mr Sonko of two offences, wey mean say dem bar am from di election, so Mr Faye bin step in.

“Bassirou na me,” Mr Sonko tell supporters recently. “Na two sides coin get,” Pastef colleague Moustapha Sarré agree.

Dis don lead to criticism say Mr Faye na merely “president by default”.

No be so, analyst Mr Tine tok. But dia relationship fit usher in a new style of leadership.

“Maybe dem go establish a tandem and break away from di hyper-presidential model of having an all-powerful head of state.

“Sonko na di uncontested leader of Pastef – an icon, even… [But] di two don get [dynamic of] complicity and collusion.”

Once upon a time, Mr Faye bin no want anytin to do wit politics. “E neva cross my mind,” e tpk for 2019 wen im dey remember im childhood.

One of Mr Faye heroes na di late Senegalese historian Cheikh Anta Diop – wey im work dey seen as a precursor to Afrocentrism. Dem see both of dem as left-wing cheerleaders for pan-Africanism.

As early results come in on Monday showing say Mr Faye dey set for victory, pipo for di capital, Dakar, bin celebrate by blowing car horns and singing to loud music.

Di reaction from international markets dey less jubilant, as Senegal dollar bonds fall to dia lowest level in five months. Reuters news agency report say investors dey concerned Mr Faye presidency may wind down di kontri business-friendly policies.

Di election suppose hold last month but Mr Sall postpone am just hours bifor campaign suppose begin, and e trigger deadly opposition protests and a democratic crisis.

Most candidates bin get veri little time to prepare once dem set di new election date – but Mr Faye bin get just ova a week afta dem release am for jail.

Despite di shortened campaign period, Senegal citizens dey determined say dem go turn out and use dia vote, Christopher Fomunyoh of di National Democratic Institute for international affairs tell BBC Newsday.

“Senegal dey in di process of confirming say democracies fit self-correct and come out stronger and more resilient.”

And di true test for Senegal clean-up guy just begin

Who be di eight pipo Nigerian Army declare wanted sake of Okuama soldiers murders

Tags: ElectionElection ResultsSenegal
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version