• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Bandits kidnap more dan 100 school children for Kaduna, tori of security breach for Nigeria

Sisi Eko by Sisi Eko
March 7, 2024
in News
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Gunmen don kidnap small pikin dem for one goment school for Kuriga town, Chikun Local Go, northwest Nigeria.

Bandits enta di LEA Primary School, Kuriga (1), and kidnap dozens small pikin dem wey dey inside di school.

Bandits carry almost 200 school children wey dey between ages of 8 and 15 enta bush on Thursday.

One goment official confam di incident to BBC say di criminal bandits kidnap over 100 pipo around 8:30 on di morning of Thursday.

Eyewitness say di school children dey assembly ground when dozens of bandits ontop motorcycles ride enta di school.

Local media for Nigeria dey report say di Head teacher of di school and some pipo wey dey work for di school dey among di pipo wey dem kidnap.

For January, bandits kill one school principal for di area and kidnap im wife.

Dis na di latest inside oda incidents wey don happun for different parts pf di kontri in di last 24 hours for di kontri wey securiy don remain one of di biggest challenges.

On Wednesday tori of kidnapping and violent clashes don dey reported.

Oda incidents wey don happun in di last 24 hours

For Borno state, dem don send one emergency response team to di remote area of Gamboru Ngala town, Northeastern Nigeria,

Dis na sake of di kidnap wey happun for one place wey displaced pipo dey stay.

Tori be say na suspected Boko haram jihadists go kidnap di pipo.

Di victims na mostly women wey dey live for camp for Gamboru Ngala town afta dem run comot from dia houses sake of attacks by jaguda pipo, locals tok.

Di kidnap happun wen di group go to collect firewood to cook or sell, dem add.

Meanwhile di United Nations condemn di mass kidnapping of pipo – mainly women and girls – from di camp wia internally displaced pipo dey stay.

Di United Nations say make dem release di victims unconditionally.

For Benue state, local media dey report say almost 50 pipo fit don die including one family wey lose seven pipo.

Tori be say jaguda pipo wey dem suspect to be Militia gang enta di Gbagir community for Ukum Local Goment Area on Tuesday morning.

Dem collabo wit di local Tiv bandits to remove anoda Tiv militia gang for di area.

According to reports most of di pipo wey die na members of di opposite militia gangs.

Dis militia gang fight also affect farmers wey di mata no concern, but unfortunately dem waka enta inside di kasala. Almost 30 pipo wound and some pipo still dey miss.

Meanwhile on Wednesday, Nigeria Senate say dem go meet wit President Bola Tinubu to tok about insecurity for Benue State and Nigeria.

Di Senate say dem go meet President Bola Tinubu afta one “Motion On di Continuing Killings by Suspected Terrorists Parading as Herdsmen and Increasing Insecurity in Kwande, Ukum, Logo And Katsina-Ala Local Goment Areas for Benue North-East Senatorial District Of Benue State.” Come up for di house.

Na Senator Emmanuel Udende, wey dey represent Benue North-East, raise di issue under “Matters Of Urgent Public Importance Pursuant To Orders 41 And 51 of di Senate Standing Orders 2023 (As Amended).”

Udende, for im lead debate, say over 50 residents of di Logo and Katsina-Ala area of di state don die and na men wey pretend like herders kill dem to cayse kasala for di communities.

Wetin be Binance? and wetin e decision to stop NGN service mean for Nigerians wey dey trade cryptocurrency

Tags: BanditsKADUNA STATEKidnap
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version