• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Court directive to DSS, oda tins wey happun as Ipob leader Nnamdi Kanu trial start

Sisi Eko by Sisi Eko
February 26, 2024
in News, Politics
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di Federal High Court for Abuja, di Nigeria capital don adjourn di hearing of di leader of di banned Indigenous People of Biafra (Ipob) Nnamdi Kanu to 19 and 20th March, 2024.

Court go rule on di bail application of Nnamdi Kanu wey di defence counsel file, while di main trial go continue on 20 March, 2024.

Justice Binta Bukar weybpreside over di case tell di Department of State Security, DSS to allow Nnamdi Kanu change clothes.

Di judge tok say dem no go allow Traditional attire and beads but im fit wear any plain clothes.

Kanu dey face charges of treason wey Nigeria goment sama am afta dem rearrest am in June 2021.

Di court hearing dey come afta di Supreme Court ruling for 15 December 2023, wey tok say Kanu must to face trial.

Di apex court dismiss di earlier judgement of di Court Appeal for October 2022 wey clear Kanu of all charges against am.

Meanwhile tori dey fly upandn say Mike Ozekhome (SAN) and Ifeanyi Ejiofor don comot for Nnamdi Kanu defence team

Mike Ozekhome, Senior Advocate of Nigeria, and Ifeanyi Ejiofor, na former defence counsels to Ipob leader Nnamdi Kanu. Na dem bin dey handle di case since.

But for court on Monday, Nnaemeka Ejiofor and Aloy Ejimakor na di lawyers wey announce appearance on behalf of Kanu.

E neva dey clear wetin make Ozekhome and Ejiofor pull out for Kanu defence team.

For phone interview wit tori pipo on Monday, Ejiofor confam say im and Ozekhome no be part of Kanu legal team, but im no gree give details.

Wetin don happen so far

Afta dem rearrest Nnamdi Kanu for June 2021, di Nigeria goment drag am bifor Justice Binta Bukar wit 15-count charge wey im plead not guilty to.

Kanu defence counsel, wey Mike Ozekhome (SAN) bin dey lead, bin apply make di court strike out all di charges against Kanu.

However Justice Binta Bukar strike out seven of di charges but tok say Kanu get case to answer for di remaining eight.

Di Seven charges wey remain for Nnamdi Kanu to answer na:

  • Terrorising pipo thru im broadcasts
  • Terrorising pipo by issuing terror threats and forcing pipo to sit at home
  • Being di leader of Ipob wey be group wey goment don ban as illegal organisation
  • Spreading message make pipo kill security operatives
  • Spreading message make pipo begin threaten and intimidate police officers
  • Spreading inciting message wey lead to destruction of property belonging to di federal goment for Lagos State
  • Secretly importing a radio transmitter and hiding it in Ubuluisiuzor community for Ihiala Local Goment for Anambra State

Di eight charges wey di court strike out include:

  • Using radio Biafra to incite di public to attack security operatives.
  • Using radio Biafra to incite di public to kill security operatives.
  • Using Radio Biafra to instruct Ipob members to construct explosives.
  • Inciting di public to scatter di Anambra governorship election for November 2021.
  • Inciting di public to destroy goment buildings and property.
  • Using terror and intimidation to force pipo to sit at home for May 31, 2021.
  • Inciting pipo to do violent protest against di federal goment
  • Inciting pipo through live broadcasts to go and destroy buses and transport facilities of di Lagos State goment, wey lead to serious economic damage for di state.

Who be di APC, LP, PDP candidates for Edo govnorship election?

Tags: NewsNNAMDI KANU
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version