• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Meet Yulia Navalnaya di ‘principled and fearless’ widow of Putin opponent Alexei Navalny

Sisi Eko by Sisi Eko
February 19, 2024
in News
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Alexei Navalny wife, Yulia don always keep low profile as she insist say her main role na to be wife and mother, no be politician.

But wit her husband death on Friday and her passionate appeal for justice for di Munich Security Conference, she don emerge as one major figure for Russia opposition perhaps by default.

Despite her background role in di past, Ms Navalnaya na ogbonge supporter of her husband, and she bin dey instrumental to get am out of Russia for urgent treatment wen dem poison am wit Novichok nerve agent for 2020.

Dem describe her as di “First Lady” of di Russian opposition.

And Alexei bin tok say im no go fit kontinu im increasingly desperate and one-sided fight against di Kremlin without her.

Many of dia supporters see dia very public love story and family life as inspiration – dem get two children

Dem born Yulia Ambrosimova for Moscow for 1976, she be di daughter of one respected scientist, Boris Ambrosimov.

Yulia na economics graduate, she bin get career for banking but she give up her job to bring up dia two children wen Alexei rise to prominence as opposition politician.

Dem bin meet during one holiday for Turkey for 1998 and marry two years later.

“I no marry promising lawyer or opposition leader. I bin marry one young man wey im name na Alexei,” she tell Russian weekly Sobesednik for 2020.

She always dey im side as e campaign against Putin – weda for political rallies or for im bedside afta Novichok poisoning for 2020.

E be like say Ms Navalnaya quickly share for Alexei politics – for di 2000s, both of dem be members of di liberal Yabloko party.

But she lead a private life until her husband poisoning for 2020, she bin make few public appearances or speeches.

Wen e dey sick and dem carry am go Siberian city of Omsk for August of dat year, she bin write directly to President Putin, and ask am to release her husband for treatment for Germany.

“Every moment wen we dey there, na how to get am out I dey think,” she tell Russian documentary maker Yuri Dud.

Wit di help of one German-based charity, dem help Navalny comot from Russia.

Yulia return wit am to Moscow several months later afta im treatment, dem arrest am immediately afta e well. E spend di rest of im life behind bars.

Former US ambassador to Russia Michael McFaul, wey call Yulia “principled and fearless”, tok say “Navalny no go fit get better partner in life pass Yulia Navalnaya. She share im convictions, im bravery, im fearlessness,” e tell US network NBC.

“She also don raise and protect dia two children in a way wey don generate deep admiration among supporters of democracy for Russia. Without question, Yulia save her husband life.”

Ms Navalnaya bin recently tok say she no go follow di path of Svetlana Tikhanovskaya, di exiled Belarus opposition leader wey become presidential candidate afta her husband go jail ahead of di elections in 2020.

Ms Tikhanovskaya dey widely considered to win di vote, wey dem rig in favour of di incumbent, Alexander Lukashenko.

But her speech for Munich and a subsequent address to supporters on social media (in Russian), wey carry emotion, suggest she fit change her mind.

“Wetin we need na free, peaceful and happy Russia. Di wonderful Russia of di future my husband so dream of,” she tok for di video address.

“Dat na di kontri I wan build together wit you. Di kontri wey Alexei Navalny imagine,” she continue.

“Dat na di only way – no oda – in which di unthinkable sacrifice e make, no go dey in vain.”

Between Kenya and Nigeria president who travel pass

Tags: NewsWidow
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version