• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Why goment close popular Sahad Stores for Abuja as hunger bite harder

Sisi Eko by Sisi Eko
February 16, 2024
in News, Nigeria, People
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) don close one big store for Abuja, Nigeria capital.

Dem close Sahad sake of say dem dey sell tins higher dan di amount wey dem suppose sell am to pipo.

Officials of di FCCPC bin go for enforcement exercise for Garki 2, wia dem close di big store on Friday 16 February, 2024.

Oga of di enforcement team, Adamu Abdullahi, wey also be di acting Executive Vice Chairman of di agency, draw ear give business pipo for di food chain.

E say make businesses wey dey put hand for tins wey dey contribute to di increase and high cost of prices for di food chain sector stop am sharp sharp, or else dem go face di law.

Dis dey come hours afta President Bola Tinubu tell all di oga of security gencies for Nigeria to collabo wit govnors to make sure say pipo stop to dey hide food.

Nigeria dey battle wit hunger, pipo begin protest for different parts of di kontri sake of high cost of living.

Forex dey scarce and nigeria goment dey find all ways to make sure say tin settle well and dey normal for pipo.

On Thursday 15 Februry, 2024, di Federal Competition and Consumer Protection Commission bin inaugurate one committee in line wit di presidential initiative to revive di economy and lower di cost of goods and services for Nigeria.

Sellers, buyers lament tough times as prices of food items dey increase on a daily basis

Prices of food items and cost of living for Nigeria dey increase for dia fastest rate for nearly 30 years. On top of global pressures, President Bola Tinubu cancellation of di fuel subsidy plus di devaluation of di currency, di naira, don add to di inflation mata wey dey groud.

For about a month now, di price of one standard 50kg (110lb) bag of rice, wey fit help feed family of between eight and 10 don turn to 77,000 naira ($53; £41). Dis na increase of more dan 70% since di middle of last year and e don pass di monthly income of plenty Nigerians.Less commercial activities, pipo wey put hand for jaw and tired faces na common sights for some buzzing Nigerian markets now.

Visit to one market for Lagos state, Nigeria biggest commercial state really show how di rising cost of food items dey show both buyers and sellers shege.

Traders lament say di price of food items too dey go up-up and e dey affect dia sales. Some say dem don even close shop as dem no fit continue in business.

“How many pipo you see wey come buy market, see as market dry? Dis na because money no dey and prices of food to cost. Pipo wey dey buy one bag of rice before, now they buy one derica because of di high cost.”

For buyers, dem say na survival mode activated. “Just buy wetin your money reach. No be cut your coat according to your size again but according to di available material.” One woman wey come buy food items for market tok.

Sake of di high cost of food items and cost of living, some states bin do protest recently.

Earlier dis month for Niger state, central Nigeria, protesters bin block roads and hold placards as dem tok say di rising prices dey choke dem.

Few days, similar protest occur for Kano state for di north-west. Afta di protest, Governor Abba Kabir Yusuf admit say pipo dey starve for im state and say dem gatz find solution.

Planned removal of subsidy on electricity – wetin e mean

Tags: AbujaNews
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version