• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Nigeria

How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

Sisi Eko by Sisi Eko
February 8, 2024
in Nigeria, Sports
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Nigeria go play Ivory Coast for dia eighth African Cup of Nations final on Sunday.

Na only Egypt, Cameroon and Ghana don appear for more Afcon final pass Nigeria.

Dis final dey come ten years afta Sunday Mba score di winning goal against Burkina Faso to give di Super Eagles dia third title for South Africa for 2013.

Many sabi pipo dey tip dem to lift di cup dis weekend based on dia experience and di talents wey dey dia squad.

Di reigning African footballer of di year Victor Osimhen dey lead di Super Eagles attack while William Troost-Ekong dey lead di defence.

Di game plan wey Jose Paseiro use for di tournament for Nigeria help Nigeria go far.

Dis na di breakdown of how di Super Eagles of Nigeria reach di Afcon 2023 final.

Nigeria 1-1 Equatorial Guinea

Nigeria come from behind to play draw wit Equatorial Guinea for dia opening group A match for African Cup of Nations.

Victor Osimhen header cancel Iban Salvador first-half goal for di 36 minutes.

Salvador fine first-half finish na im side only attempt on target for di game.

Jesus Owono bin make several second-half saves to deny di Super Eagles, and Osimhen bin miss chance afta im dey free for box.

Ivory Coast 0-1 Nigeria

Na dis game Nigeria begin show dia class for di tournament

Dem take big step to reach di last 16 of di competition wit 1-0 win ova di hosts Ivory Coast for Group A.

Di key moment for di match come for di 55th minute afta Ousmane Diomande foul Victor Osimhen inside box.

Dat allow William Troost-Ekong to score from di penalty spot.

Guinea- Bissau 0-1 Nigeria

Nigeria beat Guinea-Bissau 1-0 to reach di last 16 for di 2023 Africa Cup of Nations.

Di only goal for di match come wen Opa Sangate divert Moses Simon cross inside im own net seven minutes before di break.

Both sides bin score goals wey dem rule out as offside for second half, while Nigeria striker Victor Osimhen also get one effort wey dem cancel sake of handball.

Last-16: Nigeria 2-0 Cameroon

Victor Osimhen show why im be di best striker for Africa for dis game.

Osimhen create di chance for Ademola Lookman to score Nigeria first goal.

Na di Super Eagles striker Lookman score di two goals of di match to give im team victory.

Nigeria beat Cameroon 2-0 to reach di quarterfinals of Afcon.

Cameroon fail to register a shot on target for di entire match.

Dat statics show di difference between di Indomitable Lions and di Super Eagles for di match.

Quarter finals: Nigeria 1-0 Angola

Again Ademola Lookman carry in fine form enta di game.

Lookman first half goal bin dey enough for Nigeria to beat Angola to reach di semi-finals of di tournament.

E score afta im collect cut-back pass from from Moses Simon four minutes before di break for Abidjan.

Di 1-0 score line no really tell di real tori of di match. Angola, no bin fit play dia game, and video assistant referee (VAR) bin rule Nigeria striker Victor Osimhen 75th-minute out for offside.

Angola best chance bin fall to Zine, wey roll di ball against di base of di post wen im bin dey through on goal just before di hour mark.

Semi final: Nigeria 1-1 South Africa (aet, 4-2 on penalty)

Dis game na Nigeria toughest match for di tournament so far.

Kelechi Iheanacho score di winning penalty as Nigeria book dia place fo di final of di 2023 Africa Cup of Nations wit a 4-2 shootout win ova South Africa.

Di game for Bouake bin finish 1-1 afta ogbonge end to normal time wey see di referee go di video monitor to disallow a Victor Osimhen strike wey for put Nigeria 2-0 up – but instead dem award penalty to South Africa.

Teboho Mokoena score from di spot for di 90th minute to send di game into a goalless period of extra time wia Bafana Bafana defender Grant Kekana chop red card.

But Mokoena na one of two South African players to see dia spot-kicks saved by goalkeeper Stanley Nwabali as di Super Eagles jump to celebrate as dem reach Sunday final, wia dem go face Cote d’Ivoire afta di hosts beat DR Congo.

William Troost-Ekong bin score di opening game for di West Africans wit penalty midway for di second half, and e go now look to captain Nigeria to dia fourth continental title – and a first since 2013.

Woman wey kill makeup artist for Enugu go die by hanging

Tags: AFCONSuper Eagles
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version