• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News Politics

Latest in Senegal afta yawa gas say President Macky Sall postpone presidential election

Sisi Eko by Sisi Eko
February 7, 2024
in Politics, World
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Mobile internet access don begin work again for Senegal capital Dakar.

Dis dey happun afta authorities cut access sake of protest wey break days ago for di kontri.

Dis na as President Macky Sall bin announce one indefinite postponement of presidential election.

Di kontri elections bin earlier dey scheduled for 25 February 25, and e dey postponed by Oga Sall, sake of fight-fight ontop di candidates list.

Meanwhile, three lawmakers don dey arrested afta one rowdy session for parliament on Monday, during di debate to postpone di presidential election to December 15 even as pipo dey protest.

Di spokesperson for di dissolved opposition party Pastef, El Malick Ndiaye say three lawmakers, and one former gendarmerie captain be di latest wey dem detain. E say dis na signal of kasala for Senegal, even as e suggest say di kontri dey slide into dictatorship.

Over 200 pipo don dey arrested so far.

Some opposition figures don launch legal action for di Supreme Court.

Just like ECOWAS, di U.S. don also ask authorities to hold di election in accordance with di constitution and electoral laws.

Heavy protest rock Senegal as lawmakers bin agree to postpone di presidential election. President Macky Sall bin propose say make di election dey postponed till anoda successor dey elected.

Senegal presidential election go now dey delayed for 10 months. Di lawmakers bin postpone di election to December 15 wey lead to serious kasala for di assembly wey dem throw out opposition parties.

Di postponement lead to protest for di kontri.

Di National Assembly bin adopt di postponement bill without debate.

Di vote take place without some of di opposition wey no support di postponement and dem walk out of di room.

For inside di parliament, di opposition bin try to stop di plenary but di majority parliamentarian Benno Bokk Yaakaar quickly adopt di bill.

Di bill get 105 votes in favour and one vote against and those wey dey di camp of di incumbent president dey justify why postponement.

Di goment of Senegal announce say dem cut off mobile internet sake of di protest wey di pipo bin do against dia president.

On Sunday, di pipo of Senegal bin protest against President Macky Sall wey postpone dia residential election.

According to di Minister of Communication, im say di decision to cut off di mobile internet na becos of di ‘dissemination of hateful messages and threats wey dey disturb public order for social network’.

No be di first time wey Senegal go suspend mobile internet be dis. Dem do am for June 2023 wen a riot bin happun during di sentencing of Senegalese opposition leader Ousmane Sonko to two years in prison sake of corruption mata.

According to di Interior Ministry, social media platforms dey shut down by goment sake of di way e dey spread hate message.

Dem restore di internet connection afta 48 hours but by July 2023 dem still restrict am again

Dem restore all oda apps by dem no gree restore Tiktok and citizens for Senegal dey dey use virtual private networks (VPNs) to dey access am.

Di royal artefacts US museum return wey dem bin tiff from Asante kingdom 150 years ago

Tags: ElectionSenegal
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
People

Di Ghana 2024 elections registration wey dey target 623,000 new voters

May 9, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version