• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News Business

Dis na why Nafdac ban sale of alcohol for sachet and small-small bottles

Sisi Eko by Sisi Eko
February 6, 2024
in Business, Health, Nigeria
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (Nafdac) don announce a ban on alcoholic drinks wey dem dey sell for sachet and small-small bottles wey no reach 200ml.

For statement on Monday, di agency tok say dis ban na in di general interest of di well being of Nigeria pipo especially di under age dem.

According to Nafdac: “Alcoholic drinks for sachets, PET and Glass bottles dey pocket-friendly and dey easy to carry around by di underage (including primary and secondary school children) without notice.

“E also dey easily affordable and dey very easy for commercial bus drivers, keke riders, okada riders, etc, and afta dem don drink am, dem go dey constitute nuisance to di society.”

Di Nafdac statement also quote one report wey World Health Organisation bin do wey find out say “children wey dey drink alcohol dey more likely to use drugs, get bad grades, suffer injury or death, engage in risky sexual activity, make bad decisions and get plenty health problems”.

Di agency tok say dem bin don dey get meeting with di pipo wey dey manufacture alcoholic drinks for Nigeria, make dem stop packaging dia products for small-small containers by January 31 2024.

However, local tori pipo Punch report say di Distillers and Blenders Association of Nigeria don tok say dem go march go Nafdac office for Lagos on Tuesday to do peaceful protest sake of di ban.

Alcoholic drinks for sachets and small containers dey very common for Nigeria.

Sake of low purchasing power of di populace, even international alcoholic brands bin don dey package dia products for small-small sachets and plastic bottles, specifically for di Nigerian market, make pipo for fit afford am.

Several brands of vodkas, whiskeys, rums, cream liqueurs, gins, and bitters full Nigeria market for small-small containers wey some of dem dey sell for as low as N100.

Many Nigerian entrepreneurs don also jump into di alcoholic industry, producing dia own local brands and dia packaging na mostly for sachet and small-small bottles.

For November 2015, Nafdac open investigation on top one alcoholic brand wey im name na ‘Gallant Bitters’, after some pipo complain say dia relative die wen e take di drink.

Nafdac say investigation show say di drink get “high levels of methanol”.

“Di ban dey very good if di goment go enforce am,” Chioma Ezeobi, a clinical microbiologist, tok. “Bicos for some rural areas, even some pregnant women dey take dis sachet alcoholic drinks, sake of how easy and affordable e dey to get.

“Dem dey believe say alcohol dey help dem control di size of dia baby make delivery no hard for dem, and na small quantity so e dey safe for dem. But dem dey expose dia pikin to Fetal Alcoholic Syndrome. No amount of alcohol dey safe for pregnant woman at all at all,” Ezeobi tok.

On how dis ban fit impact di economy, sake of di companies wey dey produce di drinks, Nelson Uchechukwu Chris, an economist tok say di new directive go increase di cost of production for di alcohol companies and dia sales fit reduce.

“But di effect no go too dey drastic like dat, bicos after some time, di consumers go adjust to di new reality and di manufacturers go dey alright las las,” Mr Chris tok.

South African artist Tyla beat Davido, Burna Boy, and oda winners for di 2024 Grammys

Tags: NAFDAC
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version