• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Entertainment News

Wetin to sabi about di 2024 Grammy Awards

Sisi Eko by Sisi Eko
February 3, 2024
in Entertainment News, Music
0 0
0
0
SHARES
3
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Dis Sunday na one of di biggest nights for music for di world.

Dis time e carry Nigeria put for back as five of di biggest stars for di kontri don gbab nominations for di award show.

Plenti oda ogbonge tins dey happun including di new categories wey dey come.

Also dis go be di first time wey Nigerian go perform for di main awards show.

Ogbonge Nigerian musicians Davido, Burna Boy, Asake, Olamide and Ayra Starr dey among di nominees for di 2024 Grammy Awards.

Davido and Burna Boy dey among di nominees for “Best Global Music Performance” award category.

While, South African artist Tyla (Water) dey among di list for “Best African Music Performance”.

Five Nigerians also dey among di nominees for dis category. Burna Boy (City Boys), Davido (Unavailable), Asake and Olamide (Amapiano) and Ayra Starr (Rush).

Davido and Burna Boy also dey nominated for “Best global music album” for dis year nomination for dia album “I Told Them” by Burna Boy and “Timeless” by Davido.

Davido gbab three nominations in total for di Global Music Performance, African Music Performance and Global Music Album categories.

New categories wey Grammys dey bring come

Di Grammys create three new categories wey include di Best African Music Performance.

Di award dey to honour recordings wey use unique local expressions from Africa wey show regional musical traditions.

Di genres wey e dey cover na Afrobeat, Afro-fusion, Afro Pop, Afrobeats, Alte, Amapiano, Bongo Flava, Genge, Kizomba, Chimurenga, High Life, Fuji, Kwassa, Ndombolo, Mapouka, Ghanaian Drill, Afro-House, South African Hip-Hop, and Ethio Jazz genres among odas.

Dis dey come wit di success of songs like Calm down by Rema and Water by Tyla wey don give more visibility to African music overseas.

Di nominees for dis category na: Amapiano by Asake & Olamide; City Boys by Burna Boy; Unavailable by Davido featuring Musa Keys; Rush by Ayra Starr; Water by Tyla.

Oda new categories na di Pop Dance Recording and Best Alternative Jazz Album.

Burna Boy Performance

Burna Boy dey listed as one of di performers for di Sunday Awards show.

Tori be say dis na di first Nigerian artiste wey go perform for di main Grammy Awards show.

For 2019, Seun Kuti bin suppose perform for di Premiere Ceremony for 2019 but tori be say e no land for enough time to practice.

Burna Boy don gbab one Grammy Award for di Best Global Music Album for 2021 for im album Twice as Tall. So far e don get 10 nominations for di awards.

Dis year e dey nominated for three categories.

YouTube delete Emmanuel TV Channel of disgraced mega church leader TB Joshua

Tags: Burna boyDavidoEntertainment NewsViral
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

created by photogrid
Celebrities

Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

May 8, 2024
Entertainment News

Who be Afronitaaa and Abigail di hearing impaired child dancer from Ghana wey impress judges for Britain’s Got Talent

May 6, 2024
Celebrities

Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

April 30, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version