• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Entertainment News

Popular Lagos pastor Bishop Feyi Daniels chop life imprisonment for rape

Sisi Eko by Sisi Eko
January 27, 2024
in Entertainment News, News
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Popular Lagos pastor Oluwafeyiropo Daniels don chop life imprisonment for rape for rape.

On Friday January 26, Justice Ramon Oshodi, of di Lagos Sexual Offences and Domestic Violence Court for Ikeja bin deliver judgement on di rape and sexual assault case against di founder and senior pastor of iReign Christian Family, Lagos.

Justice Oshodi mention say Bishop Daniel dey guilty of di two-count charge against am and diafor sentence am to life and three years imprisonment wey go dey served concurrently.

According to Justice Oshodi, di prosecution team don prove beyond reasonable doubt say e dey guilty as charged.

But di court acquit am on two oda counts of rape and attempted rape.

Di court order say make dem register di convict name for di Lagos State sex offedners register.

Justice Oshodi order say make di convict serve im jail term for Kirikiri maximum prison where dem bin detain am.

According to di judge, di pastor bin use im dominant character and position to sexually violate two members of im church.

“Rape carry mandatory life imprisonment and sexual assault carry a jail term of three years, wey no fit alleviate di harm on your victims.

“In exercising di mandatory sentencing, di court tok say di convict pose significant risk to di society,” Justice Oshodi tok.

Tori bin first land for December of 2022 afta di Lagos State Domestic and Sexual Violence Response Agency (DSVA) bin deliver legal advice on top di mata say dem get enough evidence to carry mata of rape go court against di pastor.

Di report allege say Daniels bin rape assistant pastor of im church wheneva she go im house.

Bishop Daniels tok say im believe one of di women bin accuse am sake of say im bin no give her money.

For May 2023, di pastor bin dey remanded for court sake of say im rape one 25-year-old woman for im Lekki residence.

Di church member tell di court say di pastor rape am as e dey speak in tongues.

Bishop Oluwafeyiropo Daniels as im call im self be di lead pastor of iReign Christian Family.

E describe imself as “Di prophet you suppose meet and di last you go need to meet”.

Dem born am for Ekiti State but im grow up for Ogba area of Lagos State.

According to im biography, e bin fall sick at di age of eleven and doctors say im brain fit no work well.

E also dey work as businessman, as website say, “I dey run business schools, manage multinational institutions and scale firms wey dey consulted by multinationals”.

Nigeria vs Cameroon Afcon 2023 Round of 16 match preview, team news

Tags: Entertainment NewsNews
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version