• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Wetin we know about di fresh kasala wey claim pipo lives for Plateau State

Sisi Eko by Sisi Eko
January 25, 2024
in News, Nigeria
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di Nigeria Police don confirm say 10 pipo die for fresh crisis wey break out for di Mangu area of Plateau State on Tuesday.

Ebong Eyibio, wey be di Assistant Inspector General of Police in charge of di North Centra Zone, tok dis one wen e address tori pipo for Jos, di state capital on Wednesday.

Dis new death toll na in spite of a 24-hour curfew wey di state goment put on Monday to prevent escalation of violence.

Eyibio tok say two pipo wey injure for di kasala dey receive treatment for hospital, ten houses dey burnt and one car dey destroyed.

Police also parade eight pipo wey dem arrest from di recent violence, plus anoda nine pesin wey dem tok say dey involved for di Christmas eve attack for di state last December.

Eyibio wey speak through di tok tok person of Plateau State Police Command, Alfred Alubo, tok say “a delegation from di state goment, led by di security adviser to di govnor, don meet wit leaders of di Christian and Muslim communities for di Mangu Township Stadium and di Palace of of di Miskam Mwaghavul on Tuesday, 24 January to deliberate and chart a way forward to stop di katakata”.

“I wan commiserate wit di pipo of Mangu LGA for di loss of lives and properties,” di police oga tok, as e warn say “di command under my leadership go get zero tolerance for act of criminality and we go continue to dey intensify efforts to restore peace and public confidence for di state”.

“Six mosques and two churches don dey burnt down since wahala start on Tuesday,” Ado Musa, one Jos-based journalist for Daily Trust tok.

E tok say di wahala begin wen some young men try to thief cattle wey belong to some Fulani pipo. Di robbery no work, but as di thieves bin shoot gun, the cows bin scata come enta major road, na im cause di katakata.

Anoda pesin wey give im name only as Yakubu, tell BBC Pidgin say di tin start on Mondey wen pipo for di community begin dey notice some strange faces around Mangu New Market, and bicos of recent developments for di area, di community begin dey mobilise diasef and go to confront dem.

“Bifor you know fight don start and dem don begin shoot gun,” Yakubu tok.

“Di fight happun wen one boy dey pass for road, some of di hoodlums block di road, dem catch di boy and begin attack am wit knife. Na so di violence take spread.”

Di two pipo wey tok to us gree say both churches and mosques dey destroyed for dis current crisis, and pipo die for both di Christian and Muslim communities.

However, di pipo for Mangu community dey allege say security operatives no do enof to prevent dis recent attack.

“We dey wonder how dis criminals dey operate witout resistance from di security personnel wey dey deployed to di community. Our pipo dey lose confidence in di security agencies bicos dia actions dey suggest say dem don take sides,” Lawrence Kyarshik, tok tok person of di Mwaghavul Development Association bin tok for press statement on Wednesday.

However, police chief Ebong Eyibio give assurance say di mata don dey under control, and e beg di leaders of both di Christian and Muslim communities to call dia followers to order and comply wit di curfew.

Why Ogun State House of Assembly impeach Speaker Kunle Oluomo and wetin expert tok

Tags: NewsPlateau state
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version