Ogun State House of Assembly don impeach Speaker Kunle Oluomo.
Na 18 out of di 36 members of di state Assembly bin vote for di impeachment for dia plenary session on Tuesday.
Dem impeach Oluomo for alleged embezzlement of funds, high handedness and oda type offences like dat.
Afta di impeachment, di Assembly don already elect Oludaisi Elemide as dia new speaker.
For im first speech as speaker, Elemide ask for calm among di members.
E also tok say dem no use di impeachment to target Govnor Dapo Abiodun as di tori wey don dey spread dey tok.
After di whole inauguration speech, di Hose don dey adjourned for di next two weeks.
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin drag Oluomo go front of Federal High Court for Lagos to ansa case ova alleged N2.475bn money laundering.
Oluomo bin dey arraigned wit three odas for 6 September 2022. Dia names na Oladapo Samuel, Adeyemo Taiwo and Adeyanju Nimota Amoke, wey dey on di run.
Dia offence na 11 counts of conspiracy, forgery, stealing, and money laundering.
EFCC lawyer bin tell di court say dem bin commit di offence from 2019 to 2022 for Ogun State.
Rotimi Oyedepo (SAN) tell di court say dem tiff N2.475bn from di Ogun State House of Assembly treasury but dem still give Oluomo bail.
BBC Pidgin follow one constitutional lawyer tok, wey explain wetin dey inside di constitution if dem wan impeach speaker of di House of Assembly.
Human rights lawyer Inibehe Effiong explain say e dey unconstitutional make 18 Assembly members vote make dem impeach sitting speaker.
E tok say if dem get 36 members for Ogun State Assembly, dem go need 24 members to agree to di impeachment of di speaker. E tok say na two-third of di members fit impeach di speaker, according to constitution.
“By di virtue of Section 92 (2) of di 1999 constitution, dem go fit comot di speaker wit di votes of not less dan two-third of majority of all members of di Assembly,” di lawyer tok.
“Di removal no dey valid becos di house no get di number of members wey go fit comot di speaker.”
Oga Effiong advise di speaker make im challenge di case for court becos di Assembly members don commit impunity.
E add say na only majority members fit elect speaker for di Assembly in accordance wit section 92 (2) of di Nigeria constitution.
“Na two-third of all di members dem need to impeach a speaker – no be pipo wey dey present but pipo wey be members of di House,” e tok.
“If dem wan elect di speaker na one-third of di members dem need to elect di speaker based on section 96 of di constitution but dem need two- third to impeach di speaker.”