• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News Business

US court set to return stolen assets worth over ₦8.2billion to Nigeria

Sisi Eko by Sisi Eko
January 16, 2024
in Business, News, World
0 0
0
0
SHARES
4
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

One court don rule say stolen assets wey worth £6.9m ($8.9m) fit dey returned to Nigeria.

Dis dey come afta Jersey Attorney General serve forfeiture notice to di Royal Court for Jersey for November.

Di court bin rule say di money, wey dem deposit for one Jersey bank account, fit likely be moni wey officials tiff form Nigerian goment for 2014.

Di return of di assets go now dey negotiated wit di Federal Republic of Nigeria.

Di transfer of money dey disguised as goment-sanction contracts for arms during attacks by Boko Haram for Nigeria between 2009 and 2015.

Di Government of Jersey tok say e dey possible say most of funds wey dey for legit arms deals dey diverted through foreign bank accounts to and from shell companies.

Di Attorney General office tok say dem believe say di money bin go to family members of di former ruling party and dey shared among dia members during di 2015 general elections for Nigeria and say di property wey dem tok for dis bin wan dey used for di purpose of those kain “mago-mago transaction”.

Mark Temple KC, im Majesty Attorney General, tok say di goment of Jersey bin work in “close partnership” wit di Federal Republic of Nigeria to recover di property for di pipo of Nigeria.

E tok say: “Dis case again show say di 2018 Forfeiture Law dey work to recover corruption profit and bring back di money to victims of crime.

“I now get plan to negotiate asset return agreement wit di Federal Republic of Nigeria.”

Nigeria arms fraud

During Buhari administration, Nigeria former national security adviser, Sambo Dasuki, bin face di law sake of allege say e tiff $2bn (£1.3bn), im representatives bin tok.

Oga Dasuki bin chop accuse say e award ghost contracts to buy 12 helicopters, four fighter jets and ammunition. E bin deny allegations.

Di equipment suppose be for fight against Boko Haram.

Former President Muhammadu Buhari bin order Oga Dasuki arrest afta im name show for one panel wey bin investigate procurement of arm under former President Goodluck Jonathan.

Intelligence agents bin pick am from im home for di capital, Abuja, wia e already bin dey under house arrest for separate charges.

Federal goment dat time bin tok say Dasuki action cause make plenti soldiers wey no dey equipped fall for boko haram hand.

Di Jersey moni if Nigeria later recieve am, no go be di first time wey dat kind moni go dey returned to gomment from foreign account.

UK National Crime Agency, NCA bin tok say dem recover $23,439,724.98 wey associates and family of former Nigerian Head of State, General Sani Abacha siphon out of Nigeria for di1990s.

Di funds form part of one larger pool of moni wey di United States Department of Justice (USDOJ) identify as fund wey Abacha and im associates misappropriate, NCA bin tok.

Dis na more dan twenty years afta Sani Abacha regime, Nigeria still dey receive funds wey di former ruler and im associates loot.

Na wen former president Olusegun Obasanjo enta office for 1999 dem start court case to collect di money wey dem say Abacha tiff keep for many bank accounts abroad.

For May 2002: President Obasanjo do deal with Abacha family so Nigeria go fit recover $1.2 billion.

For November 2003: Finance Minister for dat time Ngozi Okonjo-Iweala tok say Nigeria don collect reach $149 million from Jersey Island inside di money Abacha steal.

For September 2005: Okonjo-Iweala again announce for one talk-talk meeting for Switzerland say Nigeria don get $458 million and like $2 billion for asset inside wetin Abacha steal.

For 2007: Finance Minister dat time Nenadi Usman talk say dem use di total money wey dem don recover, wey reach $2.5 billion – give ministry of Power, Works, Health, Education, and Water Resources to do projects.

For 2014: Okonjo-Iweala come back to say na only $500 million na im dem recover during di time she serve as Finance Minster under Obasanjo government and dem use am do community project.

For June 2014 Liechtenstein return $227 million give Nigeria, still inside di money wey Abacha thief.

For August 7, 2014, United States Department of Justice (DOJ) announce di largest money dem don give back for di organisation history, $480 million wey dem say dem go return give Nigerian government.

For 2016, Switzerland confirm say dem don return $723 million so far give Nigeria government for inside di money wey Abacha steal and wey dem seize from im family.

Dis $321 million wey dem just promise to return na di latest for inside di Abacha money wey been dey Switzerland hand. Di money bank alert enta Nigeria pocket for 2020.

Wetin be di tori about Armed Forces Remembrance Day for Nigeria

Tags: NewsUS Court
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version