• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Lifestyle Health

Doctors give pesin anoda eye, second malaria vaccine show face and oda medical breakthrough for 2023

Sisi Eko by Sisi Eko
December 29, 2023
in Health
0 0
0
0
SHARES
4
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Ogbonge research don dey for di field of health for 2023. As di year dey come to an end, we go look at some of di most significant developments.

Second Malaria Vaccine

Afta more dan one century of scientific effort, di world don finally get cheap vaccine against malaria.

Na di University of Oxford develop di vaccine and na di only second malaria vaccine wey dem go develop.

Dis na afta two years wey GlaxoSmithKline (GSK) develop di first vaccine wey dem call RTS,S.

Di World Health Organisation (WHO ) say di effectiveness of di two vaccines dey “veri similar” and evidence no dey say one beta pass di oda.

However, di key difference na di ability to manufacture di University of Oxford vaccine at scale. Dem call di vaccine R21.

Di world largest vaccine manufacturer – di Serum Institute of India – dey already line up to make more dan 100 million doses a year and plan to scale up to 200 million doses a year.

So far, na only 18 million doses of RTS,S dey.

Di WHO say di new R21 vaccine go be “vital additional tool”. Each dose go cost $2-4 and na four doses one pesin go need. Dat na about di half price of RTS,S.

Di two vaccines use similar technologies and target di same stage of di malaria parasite lifecycle.

However, di newer vaccine dey easier to manufacture as e dem require smaller dose and use simpler adjuvant (one chemical for di vaccine wey dey jolt di immune system into action).

Among mosquito-borne diseases, malaria na di most deadly and 95% of cases dey Africa.

For 2021, na 247 million cases of malaria dey and 619,000 pipo die, most of dem na pikin wey dey under di age of five.

First Eye Transplant

Aaron James, na high-voltage utility line worker for US, im lose most of im face wen im accidentally touch a 7,200-volt live wire for 2021.

For May 2023, im do one rare partial face transplant in addition to di eye transplant, wey involve more dan 140 healthcare professionals.

Surgeons for NYU Langone Health, New York, wey perform di tough operation, give update for November.

Dem say Mr James, 46, dey recover well from di dual transplant, and di eye wey dem donate look remarkably healthy. Im right eye still dey work.

Doctors say James surgery offer scientists unprecedented window into how di human eye dey try heal.

Dem also say e get direct blood flow to di retina – di part of di eye wey dey send images to di brain.

While certainty no dey say Mr James go regain vision for im new eye, doctors no dey rule out di possibility either.

Di donated face and eye come from single male donor wey dey for im 30s.

During di surgery, doctors inject adult stem cells from di donor bone marrow into di optic nerve to encourage di repair.

Afta di accident, Mr James remove im left eye becos of di pain and undergo numerous surgeries, including one for prosthetic arm.

Na im be di 19th pesin for US wey go undergo face transplant.

Wetin law tok about who go be Ondo state govnor next afta Akeredolu death

Tags: Malaria Vaccine
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Health

‘I wan live long, but e dey expensive’ – high cost of drugs hit patients for Nigeria

May 21, 2024
Health

Why court convict cosmetic doctor Dr Anuoluwapo Adepoju

May 18, 2024
Health

‘We dey like blind pipo’ – Di community for Enugu wia pipo dey live inside lack

May 13, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version