• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Rate of kidnapping for Abuja-Lokoja road put fear for travellers body

Sisi Eko by Sisi Eko
December 21, 2023
in News
0 0
1
0
SHARES
3
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Plenty tori of kidnapping along Abuja-Lokoja expressway don put many travellers for fear, especially as pipo don begin dey travel for Christmas holidays.

Abuja-Lokoja expressway na stretch of road wey connect Abuja, Nigeria Federal Capital Territory to Kogi, a state wey dey share boundary wit 10 oda states for do kontri including di FCT.

Di road wey dey about 200 kilometers na wia many travelers wey wan travel to di southern part of Nigeria from di northern region dey usually follow, and vice versa.

Recently, plenty tori about how gunmen dey attack pipo for different sections of di road don comot, even as di Nigerian police don tok plenty times say dem dey do dia best to stop di attcks.

Di latest incident happen on Sunday 18 December, wen gunmen kidnap one popular fuji musician wey im name na Omooba Wunmi, a.k.a Omooba de Jombo Beats, and him entire band, as they dey travel from Kogi State where they go perform, back to Abuja.

Na another musician, Adeyinka Adebayo (Boyobest) been raise alarm for Instagram, come tok say di kidnappers dey ask for N10m for each member of di band. Dem don release dem.

Di tok tok person for Kogi State police, William Ovye Aya, no pick him calls. E also neva respond to messages wey we send am.

Similarly, on 4 September, Daily Trust Newspaper been report how kidnappers attack two buses for Ochonyi village, along Abuja-Lokoja highway, and carry all di passengers enter bush.

One kidnap victim tok, say him no even wan remember wetin e take im eye see for kidnappers hand for September dis year.

Di man wey no wan make we reveal im identity say kidnappers been carry all passengers for di bus wey im dey inside enta forest, and “evri body for dat bus pay ransom before dem release dem”.

“Wia dis attack happun no dey far from wia we been see a police checkpoint,” di man tok. “So goment know wetin to do and who to hold responsible.”

“I no just wan begin dey tok di experience, I just dey grateful for my life, and I just dey wait make dis 2023 finish so I go know say I don survive di year”.

Di number of kidnapping wey happun for Nigeria between June 2022 and July 2023 rise from 3,359 reach 3,620, according to research wey SB Morgen Intelligence conduct, even though di report tok di figures fit dey higher sake of under-reporting.

Di report tok say kidnappers demand N6.53 billion in ransom payments for dat period, but di total actual amount wey pipo pay to regain dia freedom na N653.7 million.

“Ransom payments don become di main motivation for kidnapping for Nigeria, sake of struggling economy, rising inflation and high unemployment rates,” di report tok.

Di Nigeria police and oda security agencies don promise plenty times say them dey on top of insecurity for Nigeria, but e no be like say their efforts don bring di result wey pipo dey expect.

On Monday di Inspector General of Police, Kayode Egbetokun call meeting of top police officers to chook mouth for di plenty security issues for di kontri and review Police anti-crime strategies.

Afta di meeting di police tok tok person Muyiwa Adejobi, issue press statement wia e tok say oga IGP don reinforce deployments for di yuletide season.

Colorado Supreme Court remove Donald Trump from 2024 election

Tags: AbujaLokojaNews
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version