• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Colorado Supreme Court remove Donald Trump from 2024 election

Sisi Eko by Sisi Eko
December 20, 2023
in News
0 0
0
0
SHARES
3
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di Colorado Supreme Court don rule say Donald Trump no fit run for president next year for di state sake of insurrection.

Di court rule 4-3 say Trump no be eligible candidate sake of say im get hand for di gingering of pipo ova di US Capitol riot wey happun almost three years ago.

Oga Trump still fit run for presidency, but tins go hard for am.

Im campaign don promise say dem go carry dis mata go US Supreme Court.

Oga Trump advisers say di decision bin dey “completely flawed”.

Wetin di ruling tok gan-gan na say e go affect di state primary election for 5 March, wen Republican voters dey vote who go represent dem as presidential candidate. But dis one fit also affect di general election for Colorado next November.

Na di first time dem dey use Section 3 of di US Constitution 14th Amendment to take disqualify presidential candidate.

Tuesday decision wey dey on hold incase of appeal, till next month, only get mouth for Colorado. Dem don try pursue Trump comot ballot for New Hampshire, Minnesota and Michigan, but e no work.

Dis decision dey go against wetin one Colorado judge tok wen e rull say di 14 Amendment insurrection ban, no apply to presidents because di section no call dia name gan-gan.

Dat same lower court judge bin rule say Trump get hand for di kasala for US Capitol riot. Im supporters Congress for 6 January 2021 as lawmakers bin dey certify President Joe Biden election victory.

Di Colorado Supreme Court no go come into effect till 4 January 2024. Dat na around di deadline for di state to print dia presidential primary ballots.

Tok-tok pesin for Trump campaign Steven Cheung for inside statement say, “Democrat Party leaders dey fear ova di di growing lead wet President Trump dey get for polls. Dem no get faith for di failed Biden presidency and now dem wan do all dem fit, so American voters no go troway dem from office next November.”

Pipo wey dey in charge of Biden re-election bid no gree tok on top di Colorado ruling.

But senior Democrat wey dey linked to di campain tell CBS News, wey be BBC US prtner say di decision go help Democrats as e dey support dia argument say di US Capitol riot na attempt insurrection.

Di source say e go also help Democrats showcase di difference between Trump and Biden.

Republican lawmakers condemn di decision in fact House of Representatives Speaker Mike Johnson call am “thinly veiled partisan attack”.

Even Trump Republican primary rivals don also call out di ruling, as Vivek Ramaswamy pledge say e go comot im name from di ballot if dem no put Trump name back.

Oga Trump neva tok on top di ruling but im fundraising email wey im campaign send give supporters tok say, “dis na how dem dey born dictatorships”.

Di Colorado Republican Party say dem go withdraw from di state primary process if di ruling dey allowed to stand.

But di group wey bring up di case, di Citizens for Responsibility and Ethics in Washington (Crew) hail di ruling say “e dey necessary to protect di future of democracy for di kontri.”

Di 14th Amendment come into effect afta di American Civil War. Section 3 bin dey created to block pipo wey wan divide America to go back to di goment roles dem get before wen Southern states join di Union back.

Dem use am against Confederate president Jefferson Davis and im vice president Alexander Stephens wey bin dey for Congress. But dem no dey use am like dat since den.

Oga Trump lose by far for Colorado for di last presidential election. But if courts for more competitive states follow Tuesday ruling, oga Trump campaign go dey inside serious gbege.

For di one week trial for Colorado wey happun last month, Trump lawyers bin say make dem no disqualify am becos e no get responsibility for di US Capitol riot.

But di Supreme Court ansa say, for dia majority ruling say, Trump message before di riot na “call to im supporters to come fight and… im supporters ansa di call.”

Carlos Samour wey be one of di three justices wey vote against di ruling say goment no fit “hold back pesin right to hold public office without due process of law”.

Oga Trump dey currently face four criminal cases, wey include one federal and state case for Georgia wey relate to efforts to bend di election.

Akwa Ibom-based lawyer wey allegedly brutalise im wife chop arrest

Tags: AmericaDonald TrumpNews
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version