• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Entertainment News

Mohbad: Naira Marley wan sue Iyabo Ojo, Punch Newspaper and odas for defamation – Lawyer

Sisi Eko by Sisi Eko
December 14, 2023
in Entertainment News
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Popular Nigerian singer Afeez Fashola wey dey known as Naira Marley don begin legal action against actress Iyabo Ojo and oda pipo wey im accuse say dem publish damaging contents about am on di death of Mohbad.

Lawyer wey dey represent Naira Marley confam to BBC Pidgin di documents wey dey circulate say dem truly dey take legal action against Iyabo Ojo and demand public apology wey she go post for her Instagram page.

Lawyer Ojo Olalekan say Iyabo Ojo bin allegedly defame Naira Marley ontop di death of Ilerioluwa Aloba wey pipo sabi as Mohbad.

Olalekan say Iyabo Ojo use her Instagram account to allegedly defame Naira Marley for September 2023 wey be di same month wey Mohbad bin die.

For di letter, Naira Marley claim say Iyabo Ojo accuse am of dealing wit Mohbad “spiritually, mentally and physically” and e say dis don expose am to ridicule for di public.

“Your publication for di internet wey dey readily accessible to users dey constitute a very serious libel and e don cause vey large damage to di reputation of our client (Naira Marley).”

“Since di publication (of Iyabo Ojo) our client don receive calls from im followers, colleagues, friends and fans all ova di world wey don read di post and dem dey express dia concern about di defamation wey you falsely post for your official Instagram handle,” di document read.

Olalekan say Iyabo Ojo need to publish public apology to Naira Marley and e gatz dey posted on her Instagram handle ‘iyaboojofespris’ and national newspaper within seven days wey dem write di letter.

If afta di stipulated period Iyabo Ojo neva tender di apology, Olalekan say Naira Marley go dey forced to demand 500 million naira for damages.

“Our client dey propose say make you communicate your terms wey go help wit amicable resolutions within seven days wey dis letter come out or our client go begin legal proceedings without any consideration.”

Lawyer Olalekan tok say Naira Marley go also sue oda pipo sake of say dem join bodi spread damaging words against im client, Naira Marley.

E say Naira Marley go pursue di case go court sake of say dem dey label Naira Marley as pesin wey get hand for di death of im former signee Mohbad.

E add say Iyabo Ojo and Punch Newspaper don dey served wit pre-action notice and odas go recieve dia own by Friday latest.

“Yes, we dey go court ontop dis issue. We dey sue oda pipo wey defame Naira Marley ova di death of Mohbad and e include, Punch Newspaper and Punch online News Columnist,” lawyer Olalekan tok.

For October 2023, di Nigerian police bin invite Naira Marley and Sam Larry for interrogation and investigation into di death of Mohbad. Dem later release Marley and Larry on bail afta dem apply.

Naira Marley na former boss of Mohbad wen e sign am to Marlians record. Marley don deny all accuse say im get hand for Mohbad death.

For one statement wey im release, Naira Marley tok say im also dey traumatised sake of di death of im former signee just like evri oda pesin dey traumatised.

Naira Marley tok say Mohbad bin leave di record label for September 2022 and add say di misunderstanding wey dem get no reach make dem wish di oda pesin death.

Meanwhile, di police neva release autopsy result of Mohbad and di court don also postpone di coroner inquest on top di case till further notice.

Di death of Mohbad shake Nigeria and get di attention of pipo around di world.

Wetin we know about di broad day robbery attack wey claim lives for Ekiti state

Tags: Entertainment NewsMohbad
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

created by photogrid
Celebrities

Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

May 8, 2024
Entertainment News

Who be Afronitaaa and Abigail di hearing impaired child dancer from Ghana wey impress judges for Britain’s Got Talent

May 6, 2024
Celebrities

Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

April 30, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version