• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

House of assembly complex demolition – Rivers state political crisis

Sisi Eko by Sisi Eko
December 13, 2023
in News
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di Rivers State goment say di decision to demolish and rebuild di Rivers State House of Assembly Complex na due to di structural defects wey come about mainly as a result of di recent explosion and fire incident wey render di main building “unfit for human use.”

Na one statement wey di Rivers State Commissioner for Information Joseph Johnson issue tok so.

“Afta di assessment of di integrity of di complex, di experts warn di goment say to dey continue to use di building for im present state go dey disastrous”, e tok, noting say di goment bin try all cost saving measures towards repairing of di complex until dem get to accept di view of rebuilding di complex.

In di interim, di Rivers State Government don provide alternative venue for di House of Assembly to conduct dia affairs pending di rebuilding of the complex.” Di statement tok.

Di temporary assembly complex dey inside Government House.

Meanwhile, di Rivers State House of Assembly don pass di 2024 budget.

Dis na afta dem relocate to di state goment house as dia alternative sitting place following di ongoing renovation of di Assembly Complex.

For di resumed sitting, di House of Assembly led by Edison Ehie elect Adolphus Timothy Orubienimigha, member, representing Opobo/Nkoro State Constituency, as leader.

Di speaker also declare di seats of di 25 lawmakers wey recently defect to di All Progressives Congress, APC vacant in line with Section 109 (1) (g) and 2 of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria 1999 as amended.

Also, Govnor Siminialayi Fubara present di 2024 Appropriation bill wey e call, “Budget of Renewed Hope, Consolidation and Continuity.” to di lawmakers.

Di state executive council discuss and approve an estimated budget of N800 billion for di goment to spend for di 2024 fiscal year.

Di sum of N412bn dey projected for capital expenditure, while recurrent expenditure na N361billion with N21billion as reserve.

Prof Wokocha explain say Section 109 provide say wia dis kain tin happen, na di Speaker or a member of di House na im go notify di House officially and provide evidence to show say any of circumstances don happen including recall and such tins like dat.

“Once dem present dis proofs for di floor of di House, di speaker go declare those positions vacant. So no be for INEC to declare di positions vacant, na for di remaining members of di House of Assembly to seat, present dis facts officially and for di presiding pesin to declare those positions vacant and den INEC go dey called upon to conduct election to refill those positions.”

Wokocha say becos di remaining four members na di only legitimate members wey remain for di Rivers Assembly, dem get right to sit and carry out legislative functions like looking into and passing di budget of di state, becos di House of Assembly no dey dissolved.

“But if di legitimate members of di House declare di positions vacant, once dia actions dey officially recognised by di House say dem don resign and di positions dey declared vacant, if any of dem wan come back, he/she need to win dia party ticket and contest di conduct of election before dem fit come back.

Wetin friends tok about man wey take im own life for Abia state afta e post about am

Tags: House of AssemblyNewsRivers State
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version