D lady dey para say her man dey always waka naked for house anytime her friends dem come find her.
The woman wey no want make people sabi am share wetin dey bother am for Daily mail’s Jane green column.
She tok say she jus pack go her guy side and everything been dey go wella till she con invite her female friends come her house na im d guy con do d kyn thing wey she never imagine for her life before.
According to her she tok say d boyfriend been enter the living room with no cloth at all for hin body wey con surprise her and her friends dem.
As she con dey confront am the guy con vex say why she Dey overreact say d thing no mean and na hin house so he fit do anything wey he wan do for hin house.

Read her full gist for here:
”I jus start dey live with my man few months ago and na d first time wey any of us dey live with him partner and e been dey wondafu. We don already agree how we go take decorate d place, how we go dey divide money dey pay and everything as na wetin Dey always cause wahala for relationship. Three weeks ago I say make I arrange small gathering we me and my girls dem go just Dey dey chill na when my guy con enta room with all hin bloktos everything dey outside when say he no be small pikin. Na so I shock. The thing shock everybody sef. Na so one of my friend shout. I con think say weda hin forget say we Dey there na im I con rush cover hin body.
I pursue am comot room sharp sharp. But he con dey look me like say na me dey craze. He con ask me say why I Dey do somehow when he jus wan dey comfortable for hin own house. The thing con continue so tay I no fit even invite my friends come again. Abeg wetin I fit do for this kyn mata”.