• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home BBNaija All Stars

2023 top celebrity weddings plus di marriages wey crash for di year

Sisi Eko by Sisi Eko
December 29, 2023
in BBNaija All Stars, Celebrities, Entertainment News
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

2023 don dey wind down but many tins happun wey go dey evergreen for di mind of di pipo.

From weddings to marriage crashes, celebrity across di world bin see dia love affair enta news.

Base on different celeb fan base, dia tori wey enta di public ears bin hit differently.

some of una favourite celebrity love mata wey trend for 2023.

Davido and Chioma

For March dis year we bin hear about di marriage of Afrobeats singer David Adeleke wey pipo sabi as Davido afta e tok for interview say im don marry im finacee Chioma.

‘’I don marry’’ naso di singer tok.

Although tori about di marriage don trend before Davido confam am to di public say e don comot for market.

Di singer confam im marriage status for interview wey come out on Thursday 30 March 2023.

For di interview, Davido also torchlight im music break, new project ‘Timeless’, and Chioma,

Di singer bin take break from social media afta di death of im son, Ifeanyi.

‘’Na time to make music again’’ Davido bin add.

Made Kuti and Inedoye Onyenso

Made Kuti wey be di grand-son of di legendary afrobeat star late Fela Anikupalo Kuti marry im love, Inedoye Onyenso wey dem meet for high school.

Made and im lover bin marry on Wednesday 1, November dis year.

Plenty celebrities bin show to celebrate wit di couple.

Made na di son of popular afrobeat legend Femi Kuti and Funke Kuti.

Inedoye na fashion entrepreneur wey dey focus for different wears and accessories while Made Kuti dey follow im family music line.

Made be Inedoye school father wen dem dey High school.

Mitchel Ihueze and Nicholas Nwachukwu

For early December, Miss Universe Nigeria, Mitchel Ihezue marry her business man boo, Prince Nicholas Ukachukwu.

Di 27-year-old beauty Queen bin announce her marriage to Prince Nicholas Ukachukwu afta she bin contest for di Miss Universe Pageant for El Salavador for November.

Tori of dia engagement bin comot on di 1st of December wen she post her hand wit engagement ring for her official page .

She den add caption say, “na new month, new season, new beginning, new page don turn. Na time to write new chapter, na new dawn”.

Following dat initial review. di beauty queen reveal her pre-wedding pictures with di Anambra politician.

BBNaija All Star contestant Chukwuemeka Okoye wey dey popularly known as Frodd, marry im pharmacist partner, Chioma for January.

No be until di last week of February, na im pictures and videos of di Anambra affair start to dey show ontop social media.

Di tori comot well-well afta Frodd bin leave im heavily pregnant wife, for di middle of di year to participate inside di BBNaija All Stars competition.

Dem welcome dia girl pikin, Elena wen im still dey for di house.

BBNaija Omashola

Dis year end with banger of weddings both local and international as BBNaija star, Omashola Kola Oburoh, finally carry im partner, Britnee Malin go meet im pipo as im wife.

Di couple wey get one boy wey dem call Eyitemi run dia wedding di day before Christmas Eve.

Celebrities wey include oda BBnaija stars also follow attend di event.

Emmanuel Agyemang Badu

Former Ghanaian Footballer, Emmanuel Agyeman Badu announce im wedding for November.

Di Black Star veteran, marry im long time partner Reggiatta Affua Arthur for ogbonge wedding for Accra.

Afia Schawarzenger

Ghana Media personality, Afia Schwarzenger announce say she don comot market for August of dis year.

She reveal am with new foto wia she write her married name wey be Mrs Valentina Nana Agyeiwaa Sika Boakye-Duah.

Di celeb neva really show di face of her husband since dem marry.

Oda celebrity weddings wey trend across di world

Simone Biles

US Olympic gymnast, Simone Biles marry her NFL star boo, Jonathan Owens for May.

Di wedding bin happun as di four time Olympic champion Simon Biles bin take break from di sport for 2021 to work on her mental health.

Sofia Richie

For 22 April, model Sofia Richie marry her British music executive Elliot Grainge for one luxury hotel for France.

Tori be say na wetin carry di daughter of music icon, Lionel Richie to open her own Tiktok account as she dey show her plans for di wedding.

Celebs like Paris Hilton, and actress Cameron Diaz dey among di pipo wey attend di wedding weekend.

Vanessa Hudgens

For December, di actress Vanessa Hudgens, wey dey most popular for her role for di High School Musical feem series and di Princess Switch series, bin marry her baseball player partner Cole Tucker.

Many pipo for inside Tiktok comot to hail di wedding wey happun for Mexico sake of say before she meet her husband, di actress bin dey inside one eight year relationship with fellow actor Austin Butler.

Marriages wey crash

Yomi Gold

Yoruba movie actor and producer Yomi Alore aka Yomi Gold bin announce end of im second marriage to im wife, Meenah for January 2023.

Di actor wey im real name na Yomi Alore say dem decide to go dia separate way as love don die for dia relationship.

Dia separation bin shele barely one year afta dia marriage.

Yomi wey announce di end of dia marriage on im verified Instagram account say na di two of dem decision and e want make dia families understand.

E bin post say “Wen love die for relationship, make nobody force am.”

Bolanle Ninalowo and wife

Dis one bin make fans dey speechless wen tori begin trend say di 17-year-old marriage of popular Nollywood actor, Bolanle Ninalowo, and im wife, Bunmi, don end.

Oga Ninalowo bin tok for im Instagram handle for Friday September 1.

Di actor bin add say di split be di best for both parties.

Dis no be di first time wey di couple marriage mata go enta news say dia marriage don end.

For 2017, actor, Ninalowo bin tok for one interview say afta12 years togeda dat year, e and im wife don decide to end tins. Dey later reunite for 2018.

Faridah Sobowale

Popular Lagos State socialite, Farida Abdulkabir aka Farida Sobowale, two-month marriage bin crash for August.

For one voice note wey bin go viral for social media, Farida bin tok say her N100 million marriage wit anoda Lagos socialite, Demola Okulaja, crash afta two months.

Dj cuppy engagement/ separation

Popular Disc Jockey Florence Otedola aka DJ Cuppy separate from her fiancé Ryan Taylor.

For one tweet for July, Di popular DJ bin confam say her and her British boxer partner don separate.

Dia engagement bin shock many Nigerians dat time as some of her fans bin tok for social media dat time.

DJ Cuppy and Taylor bin engage for 2022.

Israel DMW/ Sheila

Music star Davido logistics manager, Israel Afeare aka DMW and im wife Sheila marriage crash dis year too. E no clear wen but e reach social media wen dem two come online to tok about am.

Canadian Prime Minister, Justin Trudeau and wife separate

For August, Canada Prime Minister Justin Trudeau announce separation from im wife Sophie.

Trudeau and im wife Sophie dey separate afta 18 years, following “meaningful and difficult conversations.” di PM post for im social media account.

Dem bin marry for Montreal for 2005 and get three children togeda.

For one statement, Oga Trudeau office tok say although di couple don sign separation agreement, dem go still dey make public appearances.

Doctors give pesin anoda eye, second malaria vaccine show face and oda medical breakthrough for 2023

Tags: DavidoEntertainment NewsViral
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

created by photogrid
Celebrities

Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

May 8, 2024
Entertainment News

Who be Afronitaaa and Abigail di hearing impaired child dancer from Ghana wey impress judges for Britain’s Got Talent

May 6, 2024
Celebrities

Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

April 30, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version