• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

17 sojas murdered for Delta state dey laid to rest as Tinubu, govnors plus odas pay last respect

Sisi Eko by Sisi Eko
March 27, 2024
in News
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di bodi of 17 sojas wey some yet-to-be known pipo bin kill for Okuama community Delta state don enta ground today.

President Bola Tinubu pay im last respect to di fallen sojas as di Commader-in-Chief of di Armed Forces and special guest of honour.

Di burial ceremony happun for di national military cemetery wey dey Abuja.

Several govnors and dignitaries dey in attendance.

Govnors wey dey in attendance include: Govnor of Delta state Sheriff Oborevwori, Ahmed Usman Ododo of Kogi state, Abba Kabir Yusuf of Kano state.

Di Chief of Army Staff (COAS), Lieutenant General Taoreed Lagbaja and oda high ranking military personnel dey in attendance

  • Around 4pm, president Bola Tinubu bin enta di venue of di burial. As di presideo enta, dem sing di national anthem as all dignitaries, family members and guest bin stand.
  • Di moderator greet all di pipo wey dey in attendance and announce say dem go begin bring di deadi bodi of di sojas come down for di ambulance.
  • Di officers of di Army begin dey bring di bodi of di sojas comot for di ambulances wey carry dem come.
  • Di coffin dey dressed wit Nigeria flag ontop as di officers match wit di bodi to di grave site wia dem go bury dem.
  • At about 4:36pm, di offciers carry di deadi bodi go di grave site and put di bodi for ground as dem ready to put dem inside di grave.
  • Di officers salute di coffins and march around as a sign of respect to dia colleagues.
  • Di priest offer prayer for di soul of di departed sojas. Anoda priest bin pray say dem go catch those wey do di evil.
  • Islamic cleric also do prayer for di dead sojas and pray say make dia soul rest in peace.
  • Di guests and dignitaries observe one-minute silence for di souls of di sojas afta dem blow di last horn of respect.
  • As at 4:50 pm, di Chief of Army Staff (COAS), Lieutenant General Taoreed Lagbaja deliver im remark.
  • Di Chief or Army staff say di dead sojas bin leave about 21 orphans, wit wives wey dey four to five months pregnant.
  • Di Chief of Defence staff, General Christopher Musa mount di podium to give im own remarks. Im tok say dem go surely catch those wey dey behind di killing of dia sojas.
  • Di children of di sojas go also collect scholarship up till university level including those wey dey inside belle.
  • President Tinubu also say dem go provide housing to di family of di officers and di 13 sojas at anywia dey want for Nigeria.
  • President Tinubu give im own speech. Im declare say make dem give all di dead sojas post-humous national award.
  • All di dignitaries visit di grave site of di fallen heroes to pay dia last respect. DI family members too get chance to pay respect to dia loved ones before dem enta di ground.
  • Dem fire gun into di air as a mark of respect for di dead officers.
  • Di officers salute di deadi bodi of di officers.
  • Di Army give dia vote of thanks to signify di end of di ceremony.

Di burial dey come few weeks afta jaguda pipo kill di sojas of di 181 Amphibious Battalion wey bin dey on peace mission to settle quarrel between two communities for Okuama and Okoloba for di south-south state.

President Bola Tinubu and many Nigerians condemn di killing of di sojas.

Di Nigerian leader order di military to make sure say di killers face justice.

Tinubu also promise to go give di sojas wey die national honours.

Di names and ranks of di sojas wey dem kill na:

  • Lt Col AH Ali, the Command Officer, 181 Amphibious Battalion, Nigerian Army,
  • Major SD Shafa (N/13976),
  • Major DE Obi (N/14395),
  • Captain U Zakari (N/16348),
  • Staff Sergeant Yahaya Saidu (#3NA/36/2974),
  • Corporal Yahaya Danbaba (1ONA/65/7274),
  • Corporal Kabiru Bashir (11NA/66/9853),
  • Lance Corporal Bulus Haruna (16NA/TS/5844),
  • Lance Coraporal Sole Opeyemi (17NA/760719),
  • Lance Corporal Bello Anas (17NA/76/290),
  • Lance Corporal Hamman Peter (NA/T82653),
  • Lance Corporal Ibrahim Abdullahi (18NA/77/1191),
  • Private Alhaji Isah (17NA/76/6079),
  • Private Clement Francis (19NA/78/0911),
  • Private Abubakar Ali (19NA/78/2162),
  • Private Ibrahim Adamu (19NA/78/6079),
  • Private Adamu Ibrahim (21NA/80/4795)

Wetin don happun since di Sojas death

Nigeria Chief of Defence Staff, Major General Christopher Musa say di Nigeria Army sabi who dey responsible for di killing of 17 sojas from 181 Battalion.

For one press briefing wey di CDS give last week, e say dem kill Lieutenant Colonel A.H. Ali and im men becos im bin dey try end illegal oil bunkering wey dey happun for di Niger Delta creeks.

“We sabi who do dis tin, we dey follow am up, and na just a mata of time, we sure say we go get am,” General Musa tok.

E say many of di militants wey dey do oil bunkering get plenty weapons and na one of di ones wey dey benefit from am na im kuku use di opportunity of di fight between di two communities kill Lt. Col. Ali.

Di killing of di troops make pipo of Okuama begin panic sake of fear say di military fit come revenge by clearing evribodi for di village.

But di Nigerian Army for one statement assure law-abiding citizens of Okuama say dem no go retaliate afta youth gang kill di sojas wey bin go on peace mission on Thursday 14 March.

For dia official X page on Monday 18 March, di Nigerian Army tok say make pipo of dat community continue wit dia normal activities even as efforts dey go on to arrest di criminals.

Opposition Bassirou Diomaye Faye dey lead for Senegal presidency race – reports

Tags: Delta StatePresident Bola Ahmed Tinubu
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version