Di bodi of 17 sojas wey some yet-to-be known pipo bin kill for Okuama community Delta state don enta ground today.
President Bola Tinubu pay im last respect to di fallen sojas as di Commader-in-Chief of di Armed Forces and special guest of honour.
Di burial ceremony happun for di national military cemetery wey dey Abuja.
Several govnors and dignitaries dey in attendance.
Govnors wey dey in attendance include: Govnor of Delta state Sheriff Oborevwori, Ahmed Usman Ododo of Kogi state, Abba Kabir Yusuf of Kano state.
Di Chief of Army Staff (COAS), Lieutenant General Taoreed Lagbaja and oda high ranking military personnel dey in attendance
- Around 4pm, president Bola Tinubu bin enta di venue of di burial. As di presideo enta, dem sing di national anthem as all dignitaries, family members and guest bin stand.
- Di moderator greet all di pipo wey dey in attendance and announce say dem go begin bring di deadi bodi of di sojas come down for di ambulance.
- Di officers of di Army begin dey bring di bodi of di sojas comot for di ambulances wey carry dem come.
- Di coffin dey dressed wit Nigeria flag ontop as di officers match wit di bodi to di grave site wia dem go bury dem.
- At about 4:36pm, di offciers carry di deadi bodi go di grave site and put di bodi for ground as dem ready to put dem inside di grave.
- Di officers salute di coffins and march around as a sign of respect to dia colleagues.
- Di priest offer prayer for di soul of di departed sojas. Anoda priest bin pray say dem go catch those wey do di evil.
- Islamic cleric also do prayer for di dead sojas and pray say make dia soul rest in peace.
- Di guests and dignitaries observe one-minute silence for di souls of di sojas afta dem blow di last horn of respect.
- As at 4:50 pm, di Chief of Army Staff (COAS), Lieutenant General Taoreed Lagbaja deliver im remark.
- Di Chief or Army staff say di dead sojas bin leave about 21 orphans, wit wives wey dey four to five months pregnant.
- Di Chief of Defence staff, General Christopher Musa mount di podium to give im own remarks. Im tok say dem go surely catch those wey dey behind di killing of dia sojas.
- Di children of di sojas go also collect scholarship up till university level including those wey dey inside belle.
- President Tinubu also say dem go provide housing to di family of di officers and di 13 sojas at anywia dey want for Nigeria.
- President Tinubu give im own speech. Im declare say make dem give all di dead sojas post-humous national award.
- All di dignitaries visit di grave site of di fallen heroes to pay dia last respect. DI family members too get chance to pay respect to dia loved ones before dem enta di ground.
- Dem fire gun into di air as a mark of respect for di dead officers.
- Di officers salute di deadi bodi of di officers.
- Di Army give dia vote of thanks to signify di end of di ceremony.
Di burial dey come few weeks afta jaguda pipo kill di sojas of di 181 Amphibious Battalion wey bin dey on peace mission to settle quarrel between two communities for Okuama and Okoloba for di south-south state.
President Bola Tinubu and many Nigerians condemn di killing of di sojas.
Di Nigerian leader order di military to make sure say di killers face justice.
Tinubu also promise to go give di sojas wey die national honours.
Di names and ranks of di sojas wey dem kill na:
- Lt Col AH Ali, the Command Officer, 181 Amphibious Battalion, Nigerian Army,
- Major SD Shafa (N/13976),
- Major DE Obi (N/14395),
- Captain U Zakari (N/16348),
- Staff Sergeant Yahaya Saidu (#3NA/36/2974),
- Corporal Yahaya Danbaba (1ONA/65/7274),
- Corporal Kabiru Bashir (11NA/66/9853),
- Lance Corporal Bulus Haruna (16NA/TS/5844),
- Lance Coraporal Sole Opeyemi (17NA/760719),
- Lance Corporal Bello Anas (17NA/76/290),
- Lance Corporal Hamman Peter (NA/T82653),
- Lance Corporal Ibrahim Abdullahi (18NA/77/1191),
- Private Alhaji Isah (17NA/76/6079),
- Private Clement Francis (19NA/78/0911),
- Private Abubakar Ali (19NA/78/2162),
- Private Ibrahim Adamu (19NA/78/6079),
- Private Adamu Ibrahim (21NA/80/4795)
Wetin don happun since di Sojas death
Nigeria Chief of Defence Staff, Major General Christopher Musa say di Nigeria Army sabi who dey responsible for di killing of 17 sojas from 181 Battalion.
For one press briefing wey di CDS give last week, e say dem kill Lieutenant Colonel A.H. Ali and im men becos im bin dey try end illegal oil bunkering wey dey happun for di Niger Delta creeks.
“We sabi who do dis tin, we dey follow am up, and na just a mata of time, we sure say we go get am,” General Musa tok.
E say many of di militants wey dey do oil bunkering get plenty weapons and na one of di ones wey dey benefit from am na im kuku use di opportunity of di fight between di two communities kill Lt. Col. Ali.
Di killing of di troops make pipo of Okuama begin panic sake of fear say di military fit come revenge by clearing evribodi for di village.
But di Nigerian Army for one statement assure law-abiding citizens of Okuama say dem no go retaliate afta youth gang kill di sojas wey bin go on peace mission on Thursday 14 March.
For dia official X page on Monday 18 March, di Nigerian Army tok say make pipo of dat community continue wit dia normal activities even as efforts dey go on to arrest di criminals.
Opposition Bassirou Diomaye Faye dey lead for Senegal presidency race – reports